Fifa ban no go land Nigeria head as goment recognise Amaju Pinnick as football president

Amaju Pinnick

Wia dis foto come from, other

Wetin we call dis foto, Pinnick na also first vice president of Caf
Read am in 1 mins

Nigeria football don escape ban from Fifa wey be di pipo wey dey run football for di world as goment recognise Amaju Pinnick as di ogbonge President of di Nigeria Football Federation.

Fifa bin give Nigeria until 12pm on Monday, to solve di wahala wey dey dia football as to who be di president. Fifa don tok before say na Amaju Pinnick be di pesin wey dem sabi.

As clock dey waka dey go reach 12pm wey be di deadline dem give Nigeria, na im Laolu Akande wey be Special Assistant to Vice President Yemi Osinbajo, tweet say di goment don already inform FIFA of dia decision.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wahala don dey since about who be di head of Nigeria Football Federation between Chris Giwa and Amaju Pinnick.

Last week, Giwa and im pipo take over di NFF office for Abuja afta one court for Jos bin cancel di election wey make Amaju Pinnick president.

Giwa sack Mohammed Sanusi, wey be NFF General Secretary and oda members of di executive.