Kepa Arrizabalaga and oda goalkeepers wey cost well-well for football

Wia dis foto come from, Getty Images
Chelsea go break di world record fee for goalkeeper if dem sign Kepa Arrizabalaga from Athletic Bilbao.
Arrizabalaga don pay im release clause of £71m to di La Liga club, wey go allow am leave dem and clear way for im transfer come Premier League.
Dis deal go be world record fee for goalkeeper, even pass £66.8m money, wey Liverpool pay to buy Alisson for July.
Di blues dey bring in Kepa to replace Belgium international goalkeeper Thibaut Courtois .
Goalkeepers no dey too break record for transfer, but make we see di top five wey don cost well-well for football.
1. Alisson - £66.8m Roma to Liverpool for 2018

Wia dis foto come from, Getty Images
2. Ederson - £35m Benfica to Man City for 2017

Wia dis foto come from, Getty Images
3. Gianluigi Buffon - £33m Parma to Juventus for 2001
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
4. Jordan Pickford - £25m Sunderland to Everton for 2017

Wia dis foto come from, Getty Images
5 Manuel Neuer - £21m Schalke to Bayern Munich for 2011

Wia dis foto come from, Getty Images












