Man City v Chelsea Community Shield 2018: Why e no show for satellite TV

Man City players cari Community Shield trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Man City also win last season EPL trophy
Read am in 2 mins

Football fans wey dey for West Africa no watch di 20018 Community Shield match between Chelsea and Manchester City on Sunday 5 August.

Dis na because di satellite TV provider wey most pipo dey use for di region, no get right to show di match wey happun for Wembley Stadium.

Pep and Sarri

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na di first time Guardiola and Sarri go play for di cup

Man City win di match 2-0 afta Argentina striker Sergio Aguero score one goal for first half and anoda one for second half.

Tori be say to buy di right to show di match cost pass wetin dem bin dey expect and dem no too push for am as na just one of game.

E dey normal for di satellite TV network to promo matches and games wey go come up for dia sports channels ontop social media but dem no tok anytin about di Community Shield game, instead na oda games dem dey promo.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di Community Shield game dey happun everi year before di English Premier League season dey start.

Di game na between di League champion and di FA Cup winners and e dey signal di end to di pre-season and beginning of di new season.

Chelsea coach Maurizio Sarri

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Community Shield na di first game wey new Chelsea coach Sarri go play for English league

All di money from di game dey go to charity.

Na di first time wey Man City coach Pep Guardiola and new Chelsea oga Maurizio Sarri play Community Shield.