Nigeria v Atletico Madrid: La Liga club don announce team wey go play Super Eagles

Wia dis foto come from, @atletienglish
Spanish club Atletico Madrid don release di names of players wey dem dey cari go Nigeria for friendly with Super Eagles.
Di club wey win di Europa League last week Wednesday, bin play 2-2 draw for home for dia last league game against Eibar.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di friendly game wit Nigeria go happen on Tuesday 22 May 2018 and e go start by 6:00 pm (West African Time) for Godswill Akpabio Stadium, Uyo.
Nigeria bin don announce say na dia B team go play di match.








