You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Bukom: How one area for Ghana dey produce boxing world champions
23 year-old Ghanaian boxer Isaac Dogboe na di new WBO World Super Bantamweight champion afta im nock out American Jessie Magdaleno for Philadelphia.
Dogboe win over Magdaleno make am di youngest Ghanaian to be World Champion.
But im no be di first Ghanaian to be World Champion for boxing.
Nelson Azumah
Nelson Azumah na one of di greatest boxers from Ghana, im guy name for ring na 'Professor' because of di way im dey fight.
Nelson win plenty boxing fights and title for im career.
For 1984 im beat Wilfredo Gomez to win di WBC featherweight Championship.
Im no stop dia as im move go WBC super featherweight wia im win di title two times.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ike Quartey
Ike Quartey na anoda Ghanaian boxer wey do big things for di sport.
Quartey compete from 1988 to 2006 and during dat time im hold di WBA welterweight title for four years.
Joshua Clottey
Joshua na boxer wey pass through di popular street of Bukom, place wey don produce boxing champions dem for di kontri.
For 2008, Clottey beat Zab Judah to win di IBF Welterweight title for Las Vegas.