Anthony Joshua: Di one tin wey remain for am

Read am in 1 mins

British-Nigerian boxer Anthony Joshua beat Joseph Parker inside boxing match for one world heavyweight title on Saturday for Cardiff.

Na points Joshua use win di match with score of 118-110 118-110 119-109 as referee dem take see di fight.

Di 28 year old Joshua use im left hand throughout di match to tackle Parker wey try well-well to endure am.

Wetin remain now for Anthony Joshua

Di world heavyweight titles wey Joshua get now na four - WBA, IBF, WBO and IBO. Im be di first person to reach dis kain level for world of boxing after Mike Tyson and Lenox Lewis.

But to be di main di main Baba for boxing for di whole world, wey be undisputed champion, Joshua go get to fight Deontay Wilder next. Wilder na im hold di WBC belt and e don tey wey Joshua dey put eye for dat one.

From di video wey Wilder post for im social media, e be like say im dey redi for Joshua.