Barcelona and Liverpool don sign new players

Barcelona don complete deal to sign Borussia Dortmund forward Ousmane Dembele for initial fee of £96.8m, wey fit rise reach £135.5m.

Di deal na di second most expensive wey dem go pay for any player. Na only Neymar fee of £200m move to Paris St-Germain pass am.

Barca say Dembele contract get release clause of 400m euros (£369.6m).

Dembele skills wey attract Barca attention

Na di second biggest transfer

2017 - Neymar £200m (Barcelona to Paris St-Germain)

2017 - Ousmane Dembele £135.5m (Dortmund to Barcelona)

2016 - Paul Pogba £89m (Juventus to Manchester United)

2013 - Gareth Bale £85m (Tottenham Hotspur to Real Madrid)

2009 - Cristiano Ronaldo £80m (Manchester United to Real Madrid)

As Dembele own dey happen, for England Liverpool don agree club-record deal to sign Leipzig Guinea midfielder Naby Keita.

Liverpool agree to pay £48m release clause wey go allow am move next summer, plus undisclosed premium.

Di 22-year-old na one of Jurgen Klopp main target for summer, but Leipzig no gree sell.

Di deal fit pass di £35m wey dem pay to Newcastle to sign Andy Carroll.