NDA Kaduna attack update: Nigerian Defence Academy 'unknown gunmen' invasion - Buhari react/Timeline

Wia dis foto come from, BASHIR AHMAD/FACEBOOK
Less than 48 hours Nigerian Defence Academy [NDA] suffer 'unknown gunmen' attack di kontri defence HQ dey ask media to present di Armed Forces well for dia tori.
Di security breach for NDA make many Nigerians wonder as pipo dey ask plenty kwesions wey di Nigeria military neva wan ansa.
And dis don give room to plenty concerns as local tori pipo dey report different tins from unconfam sources.
However, di new Director of Defence Information, dey appeal for positive coverage from Nigerian media at dis time.
Major General Benjamin Olufemi Sawyerr drop di appeal wen im visit di heads Voice of Nigeria and di Federal Radio Corporation of Nigeria on Wednesday 25 August.
But since dis 'unknown gunmen' or bandits enta Nigeria prestigious military university, many kontri pipo dey ask di following:
Who be dis pipo wey get mind enta military formation kill officers? How dem take enta? Dem bin get inside help or how?

Wia dis foto come from, Getty Images
NDA Kaduna attack: How President Buhari react to Nigerian Defence Academy 'unknown gunmen' invasion
Presidential tok-tok pesin Garba Shehu say di recent attack on di NDA na attempt to embarrass President Muhammadu Buhari goment.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria Commander-in Chief of di Armed Forces tok inside statement say:
Di attack on NDA no go make di morale of di Armed Forces low, instead e go ginger dem to end criminality decisively for di kontri.
Dis attack dey come wen di military don already push back insurgents, bandits, kidnappers, and oda types of criminals. Di presidency add.
Oga Buhari tell sorry to di family of di officers wey die, den promise say dem "no go die in vain."
Di statement wey pesin Garba Shehu sign describe di incident as "sad and unfortunate".
E say many scenarios na im pipo dey paint on di circumstances wey lead to di incident.

Wia dis foto come from, Directorate of Defence Information
NDA Kaduna attack: Timeline of how tins take happun
On August 24, according to statement wey di Academy release - "unknown gunmen breach di security architecture or design of di Nigeria Defence Academy" Headquarters for Afaka, Kaduna.
Di gunmen enta di residential area kill two pipo plus kidnap one pesin.

Wia dis foto come from, Getty Images
24 hours afta di attack on 25 August, local tori pipo Cabel online news media report say;
Di military pipo wey suppose dey on duty to monitor di CCTV cameras bin dey sleep.
Hours afta di Cable publish dia story on di same 25 August, di Defence Headquarters do press release to counter di claim wey accuse di news media of propaganda.
Di statement say dem dey "state categorically say di allegation no be true and dia fore challenge di Cable Online to publish verified proof.
"Therefore e dey important to warn Cable Online media make den deyc areful against pipo using em as propaganda tool by enemies of our dear kontri."
Still inside August 25, di director of defence information go do familiarisation visit to DGs of two of di kontri biggest media organisations.

Wia dis foto come from, Nigeria Defence Academy
NDA Kaduna attack: Latest from Nigerian Defence HQ
Major General Benjamin Olufemi Sawyerr say make di "media continue to support and cooperate wit di military through positive coverage and reporting of activities in order to move di kontri in di path of peace and progress."
Dem describe di media as very powerful instrument wey dey coordinate all di powers to help di kontri develop.

Wia dis foto come from, Directorate of Defence Information
Meanwhile many ordinary Nigerians wey don react to di story no happy over di use of di word "unknown gunmen" by di NDA to describe di attackers.











