Corruption Perception Index: Nigeria drop to worst since 2015 sake of Police bribery, odas

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria don record dia worst ranking for di Transparency International Corruption Perception Index since 2015 to 149 out of 180 kontris.Di organisation say dis rating dey based on lack of transparency, nepotism, lack of beta anti-corruption legal framework and di way bribery and extortion be for Nigerian Police.
For di 2020 index wey dem release on Thursday, e show say Nigeria score 25 over 100 points, wey move am to 149 of di 180 kontris dem survey.
Nigeria don drop three steps down from 146 position dem bin get for 2019.
Dis one place dem for di same position wit Cameroon.

Wia dis foto come from, Getty Images
Transparency International tok say in di past four years, Nigeria don dey drop for dia corruption index at di rate of 0.6%.
Di Civil Society Legislative Advocacy Centre (CISLAC)/ Transparency International Nigeria bin offer some recommendation to fix di palava and dem include:
- Transparency on how state and non-state actors dey use covid 19 relief funds.
- Appointment of Public service must dey on merit to comot nepotism.
- Make National Assembly sharparly pass relevant anti-corruption laws.
- Goment must to reform police and dem need do wetin dey di Police Act of 2020.
- Di goment must make sure say dem get democratic and civic space to take tok wit kontri pipo dem and di media.
- Make dem create anti-corruption framework wey go make sure say all di efforts to fight corruption no go come from di federal level alone.








