Bobi Wine: Ugandan Police say dem cari am go house from campaign ground

Wia dis foto come from, Bobi Wine
Police for Uganda don announce say dem prevent Bobi Wine to do election rally and don carry am go back house.
Police bin don arrest Ugandan Presidential candidate Robert Kyagulanyi, wey dem dey popularly call Bobi Wine for di Lake Victoria sland of Kalanga wia im bin dey campaign.
Na im team announce di occurrence for im official Twitter handle.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Sources for di opposition, National Unity Platform bin also add say dem carry im whole campaign team follow bodi for di arrest.
Tori pesin wey bin dey di campaign trail tell BBC say security forces bin dey select online journalists and bloggers and bin dey arrest dem.
Social media videos also show as dem pack both military and police for di island.
Kasala burst since on Sunday, wen gbas gbos between Bobi wine supporters and police bin lead to di injury of one journalist and one millitary vehicle allegedly hit and kill one o di singer and politician body guard.
On Monday, journalist waka comot one press conference wey army bin give, in protest ova how security forces dey treat media wey dey cover opposition for di election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Plenti-plenti kata-kata don follow dis January presidential election as for November, ova 50 pipo die ofr two days of protest wey happoun ova di arrest of Bobi Wine for Easter Uganda.












