Edo State Governor Election 2020: Meet di former governors of Edo state and dia biography

Wia dis foto come from, FACEBOOK
Ten govnors don rule Edo state since di creation of di state for 27 August 1991 wen dem divide di former Bendel state into Edo and Delta States.
On di 19 of September 2020 wen pipo for di state go come out come vote, di state go either witness di emergence of a new govnor wey go rule di state for di next four years or di incumbent fit remain for office.
Past Govnors of Edo State
- COL. JOHN EWEREKUMOH YERI (August 1990 - January 1992)
Colonel John Ewerekumoh Yeri na Nigerian soldier wey serve as Military govnor of Bendel state between 1990 and 1991. Im continue as govnor of di state until January 1992 wen di den Military President General Ibrahim Babangida divide Bendel state into two - Edo and Delta states. Yeri na di first military governor of Edo state and e help di state move smoothly from military to civilian goment.
For di speech im give for December 1991, im say Military Administration hold traditional rulers in high esteem, and di military expect say dem go teach dia subjects about Government policies and programs for grass root level. During im tenure, di administration bin invest for road construction for di state.
During di election, Social Democratic Party (SDP) bin win di Gubernatorial election for di state. For January 1992, im hand over power give John Odigie-Oyegun.
- John Odigie-Oyegun (January 1992 - November 1993)

Wia dis foto come from, John Odigie Oyegun/FACEBOOK
Dem born John Odigie Oyegun for August 12, 1939, for Warri, Delta State. Im serve as di first national chairman of All Progressives Congress (APC) for Nigeria.
Im attend St. Patrick's College, Asaba, and e go University of Ibadan where he obtain Bachelor's degree in Economics. He then serve for various capacities as a federal civil servant wia im work as development planner.
Dem elect Chief John Oyegun as civilian governor of Edo State on top di SDP platform, during di transition to democracy wey General Ibrahim Babangida launch and e rule from January 1992 to November 1993.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem comot am from office after General Sani Abacha seize power. Later, e become di leader of di All Nigeria Peoples Party (ANPP).
- Colonel Mohammed Onuka (9 December 1993 - 14 September 1994)
Col. Mohammed Abdul-Salam Onuka take over from di Civilian Governor of di state as di Military Administration of Sani Abacha start. Im serve as Military Administrator of di state from December 9th 1993 to September 14th 1994.
Col. Onuka interest na for di Tourism sector of di state. E reason say di state get plenty tourist attraction site wey go yield revenue for di young Edo state if dem manage am well.
Im bin try to develop di tourism potential wey dey di scenic area of Ososo but e no fit fulfil di dream of making Ososo tourist heaven before another colleague in uniform take over di leadership of di state.
- Colonel Bassey Asuquo (14 September 1994 - 22 August 1996)
Colonel Bassey Asuquo na from Odukpani Local Government Area, Cross River State. Im serve as di military governor of Edo state from 14 September 1994 - 22 August 1996. Before im appointment, im serve as di Military Administrator of Delta State between December 1993 and September 1994.
Im retire as Brigadier General for di Nigerian Army.
Col. Asuquo na di Clan Head of Anim Ankiong Clan Council of Odukpani Local Government area in Cross River State. He testify before di House Committee on Power and Steel wey dey torchlight how dem take spend di money wey dem pay for di Calabar 561MW GT power station, he say na di contractors delay di project no be di community dey cause kasala on top di project.
For September 2009 dem appoint am as di chairman board of di Federal Psychiatric Hospital, Calabar.
- Group capt. Baba Adamu Iyam (August 22 1996 - August 7, 1998.)
Group Captain. Baba Adamu Iyam become di Military Governor on August 22 1996, di position e occupy till August 7, 1998. As im take ova leadership, im first sack 8,000 Edo state workers from service. Im no stop there, for February 1997, e stop all grants wey dey go Edo State University, Ekpoma as e tink say goment no suppose dey fund universities. Di academia and workers for di state no go quick forget wetin do dem during di regime of Adamu Iyam.
- Navy captain A.I. Onyearugbulem (August 7 1998 till 29 May, 1999)
Onyearugbulem bin comot di Peoples Democratic Party (PDP) and e declare im intention to run in 2003 for governor of Imo State on di All Nigeria Peoples Party (ANPP) platform. Later that year, Onyearugbulem die suddenly for im hotel room for Kaduna wey make pipo wonder wetin fit happun. During im time as di Military Administrator of Edo State, e join issues wit di Oba of Benin.
Navy Captain Onyearugbulem suspend Oba of Benin on top claim say e endorse APP governorship candidate.
Dem born Anthony Ibe Onyearugbulem for 9 July 1955 for Owalla Avuvu in Ikeduru, Imo State. E go school for St. Columbia's Secondary School, Amaimo (1970-1972) and Enyiogugu High School, Mbaise (1972-1974). E later join di navy.
- Chief Lucky N. Igbinedion (29 May, 1999 - 29 May, 2007)
Lucky Nosakhare Igbinedion become di governor of Edo state under di platform of Peoples Democratic Party (PDP) on May 29th 1999 after democracy return.
Dem born am on 13 May, 1957. Im rule di state from 1999 to May 29, 2007. During im reign, dem sabi am as di action governor as e clear di salaries dem owe Edo state workers especially Observer staff for 19 months. Dem go remember im administration for human capacity development. and for di fight against human trafficking and prostitution, di fight wey im wife Eki Igbinedion bin lead.
After e comot office, di Economic and Financial Crimes Commission declare am wanted on January 2008 on 142 counts of financial fraud. Di allegations na say e embezzle 24 million dollars i.e 12 million pound using fake companies.
- Prof. Oserheimen Osunbor (29 May 2007 - 11 November 2008)
Dem born am for October 5, 1951 in Iruekpen di present day Esan West Local Government Area of Edo State.
On May 29, 2007, PDP produce Prof. Oserheimen Osunbor as di governor of Edo state. He serve as di Civilian Governor of di state from May 29, 2007 to November 11, 2008 becos court later nullify im election.
- Adams Aliyu Oshiomhole (12 November, 2008 - 11 November, 2016)

Wia dis foto come from, ADAMS OSHIOMOLE/FACEBOOK
Dem born Adams Aliyu Oshiomhole for 4 April 1952, im be di former national chairman of di All Progressive Congress. Oshiomhole bin serve as di president of Nigeria Labour Congress from 1999 to 2007 and di executive governor of Edo State, Nigeria from 2008 to 2016.
As APC national chairman, dem suspend am from office by di Abuja Court of Appeal on 16 June 2020.















