Edo State Governorship Election: How President Muhammadu Buhari endorsement of Osagie Ize-Iyamu go affect im friend Gov. Obaseki

Wia dis foto come from, Presidency
President Muhammadu Buhari don approve alias endorse Pastor Osagie Ize-Iyamu as di candidate of Nigeria ruling All Progressives Congress (APC) ahead of di 19 September, 2020 governorship election in Edo State.
Di Nigerian leader press hand for di APC Governorship Candidate on Friday 7 August, just two months afta Pastor Ize-Iyamu port comot from di kontri main opposition Peoples Democratic Party (PDP) to join di ruling APC for di southern state of Edo.

Wia dis foto come from, Presidency
Wit just a little over a month or five weeks before di governorship election for Edo State, wetin Buhari do mean say im go back im party candidate over im friend and current Govnor Godwin Obaseki wey dey also contest di 19 September vote.
Na just for June, wen Obaseki never port comot di president APC party, na im e meet Presido Buhari to show am say e don buy nomination form to contest di June primaries as Governorship aspirant for Nigeria ruling APC before e finally port comot go join di main opposition PDP.

Wia dis foto come from, Twitter/Godwin Obaseki
Govnor Godwin Obaseki dey find second term for office but APC screening committee disqualify am on top alleged fake certificate, before e port comot go join PDP.
Govnor Godwin Obaseki on Friday explain how di current Edo House State House of Assembly crisis wey lead to declaring 14 lawmakers seat vacant afta 180 days as e follow for di whol political crisis ahead of di 19 September, 2020 election.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Presidency
President Buhari receive di APC governorship candidate togeda wit di National Chairman, APC Caretaker Committee, Gov. Mai Mala Buni of Yobe State, di APC Campaign Chairman for Edo State wey be Governor of Kano State, Dr Abdullahi Umar Ganduje and Governor of Kebbi State, Abubakar Atiku Bagudu.

Wia dis foto come from, Presidency
Osagie Ize-Iyamu na pastor and politician. Im bin contest against Obaseki for di 2016 govnorship election as candidate of di opposition Peoples Democratic Party.
End of Di one wey oda users dey read well well
Pastor Ize-Iyamu dey for di centre of di battle between Godwin Obaseki and Adams Oshiomole, and im na di candidate wey dey enjoy Oshio Baba support pass to represent APC for di 2020 election.

Wia dis foto come from, Osagie Ize-Iyamu
Im be one time chief of staff and secretary to di Edo state goment. But e get heavy corruption case wey dey hang for im neck.
President Buhari win election for 2015 and 2019 sake of im fight against corruption but e belike say di Nigerian presido never see any reason to consider di corruption accuse against di new APC candidate as a big deal.
For Nigeria, di president party or di party wey im dey support get higher chance to win governorship elections.
Even though Gov. Obaseki don waka from APC join PDP, Edo State matter to APC
Politics na game of numbers and every state dey important to any political party.
For Nigeria ruling All Progressive Congress party, di more states wey dem get to govern, di more power wey dem go fit enjoy on top different states.
Until Edo state governor Godwin Obaseki bin resign from APC on June 16, 2020, di party bin dey control 21 states while opposition Peoples Democratic Party bin dey im charge of 15 states.
As govnor Obaseki register as PDP member on Friday 19 June, e mean say di party now get 16 states, at least till di 19 September election happun.
On top of dat, Edo na di only state wey APC bin fit get for South-South Nigeria afta di 2019 governorship election for Nigeria.
We still dey chook eye for dis tori, make you dey refresh dis page for more updates.















