Edo State House of Assembly: Govnor Godwin Obaseki clash police, accuse Adams Oshiomhole, Hope Uzodinma of attempt to 'take over im government'

Edo State House of Assembly
Read am in 5 mins

Govnor Godwin Obaseki on Thursday order and remove di roof of Edo State House of Assembly make nobodi do sitting afta di govnor kwanta wit police team wey attempt to take over di Chief Anthony Enahoro Complex.

Before govnor Obaseki order contractors to turn di Assembly complex for Creek Road to renovation project site, e bin don pursue police officers wey bin take over di building of di Edo State House of Assembly wey dey di state capital, Benin.

Di govnor tell BBC Pidgin through im tok tok pesin Crusoe Osagie say na attempt by some big politicians including a govnor of anoda state to take over di Edo State House of Assembly and cause gbege for im goment ahead of di 19 September, 2020 Governorship election for di state.

Edo State House of Assembly
Wetin we call dis foto, Edo State House of Assembly and some of di roof wey 'contractors' don pull down

According to di Edo State Govnor: "Na attempt by Adams Oshiomhole and some members of di APC, including di govnor of Imo State Hope Uzodinma.

"Dem dey try use force to seize control of di House of Assembly complex wey currently dey under renovation and reconstruction.

We hear say dem go do fake mace somewhere and use am storm di House of Assembly wey no dey function right now sake of renovation, to illegally inaugurate parallel House of Assembly for di state on Thursday morning."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Edo State House of Assembly

Di speaker of di House of Assembly, di deputy speaker and di govnor of di state bin come here dis morning to spoil di plan. We wan prevent any crisis, na why we dey raise alarm so dat di presidency, security agencies, even di Inspector General of Police fit no dey aware of wetin dey happen." Osagie tok.

Govnor Godwin Obaseki call on di presidency and security agencies to call dis pipo to order and prevent any death.

Im say govnor Obaseki dey disappointed say pipo wey suppose be elders go fit try cause dis kain katakata.

For about two months now, di members of di House don dey do dia meetings for di old legislative chambers for Benin. Di Special Adviser to di Govnor ontop Media and Communication Strategy, Crusoe Osagie wey bin follow BBC Pidgin tok on behalf of di Govnor, accuse Oshiomhole heavy accuse say na im dey behind di attempted take over.

Govnor Godwin Obaseki on Friday explain how di current Edo House State House of Assembly crisis lead to declaring 14 lawmakers seat vacant afta 180 days.

Obaseki for one world press conference say wetin dey happun now, ahead of di 19 September, 2020 governorship election, bin develop from di whole political crisis wey start for June 2019 wen e proclaim di 8th Edo State House of Assembly.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Govnor Godwin Obaseki dey lie o! - Adams Oshiomhole

Oga Oshiomhole tok tok pesin Simon Egbegbulem tell BBC say all wetin Govnor Obaseki dey tok no be true. "Oshiomhole no get hand inside wetin dey happun for Edo State House of Assembly."

"Im no get bizness, im no be lawmaker, e no dey inside di assembly, e dey far away from im village inside Iyamor wia im dey campaign for im party for di coming election and e no get bizness wit wetin dey happun in di assembly."

Edo State House of Assembly

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Adams Oshimhole (L) and Godwin Obaseki (R)

Wetin dey really happun for di assembly, (I tink di govnor just dey lie) na say... you know say we get 24 member house of assembly, and 20 of dem na APC members, then you get four PDP members and as you dey aware, di govnor don waka go PDP. Egbegbulem add.

"So because di APC na di majority for di house, na dem suppose produce di Speaker, Deputy and oda senior positions for di house because na dem be majority, but di govnor dey stop dem from entering di assembly."

E (referring to Gov. Obaseki) take police and thugs, wey take over di place right now, and e dey pull down di roof of di assembly house to stop dis pipo (di 20 APC lawmakers) from operating and cari out dia lawful duty, Oshiomole tok tok pesin add put.

Di former national chairman of Nigeria ruling APC na native of Edo State.

Govnor Hope Uzodinma express disappointment

And Govnor Hope Uzodinma of Imo State for im respond to di accuse as at di time of dis tori na say im dey disappointed at wetin Gov Obaseki dey yan. Gov Uzodinma tok tok pesin Oguwike Nwachuku say:

"Allegation dey quite unfortunate, coming from pesin wey claim to be a Speaker. E go to show how deep im don sink in daylight hallucination and thoughtlessness."

Pipo wey hold placards

Tori be say di govnor and di speaker of Edo State House of Assembly on Thursday prevent wetin for mean by force take over of di assembly complex.

Na early morning na im a group of police men and some members of di House of Assembly wey dem never still swear in, waka visit to di Chief Anthony Enahoro Complex, na dia crowd of supporters gather block di city centre.

Shortly afta di govnor leave di assembly complex, construction trucks drive into di assembly gate begin deliver stones and sands for di main gate.

Di speaker wey bin escort di govnor also give instruction of no entry into di Assembly complex.

Edo State House of Assembly
Wetin we call dis foto, Trucks dey move in sands and stones to di assembly entrance while di speaker and di deputy govnor dey supervise

For now, all appears calm wit supporters wey dey rejoice as dem dey see payload of sand and stone delivered to di troubled assembly complex.

Dis incident dey come shortly afta di state members of Assembly bin impeach di Deputy Speaker of di House, Yekini Idiaye. Dem bin replace Idiaye wit Roland Asoro, one lawmaker wey dey represent Orhionmwon II Constituency.

Edo State House of Assembly
Wetin we call dis foto, Edo State House of Assembly roof na im di pipo wey di govnor bring dey remove on Thursday morning so dat no sitting fit hold. But di Govnor office tell BBC Pidgin say di work men go to renovate di Assembly complex. And say di lawmarkers don move go di old Assembly complex.
Edo State House of Assembly

Some videos and foto bin show heavy police presence inside di State House complex on Thursday, 6 August, wit patrol motor car dey blast siren.

Even though Gov. Obaseki don waka from APC join PDP, Edo State matter to APC

Politics na game of numbers and every state dey important to any political party.

For Nigeria ruling All Progressive Congress party, di more states wey dem get to govern, di more power wey dem go fit enjoy on top different states.

Until Edo state governor Godwin Obaseki bin resign from APC on June 16, 2020, di party bin dey control 21 states while opposition Peoples Democratic Party bin dey im charge of 15 states.

As govnor Obaseki register as PDP member on Friday 19 June, e mean say di party now get 16 states, at least till di 19 September election happun.

On top of dat, Edo na di only state wey APC bin fit get for South-South Nigeria afta di 2019 governorship election for Nigeria.