International flight resumption: Nigeria President Buhari give greenlight for airlines to begin process to reopen

President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, @NGRPresident Twitter

Nigeria President Muhammadu Buhari don approve di extension of di second phase of di eased lockdown for anoda four weeks.

Dis extension na di third for di second phase of lockdown wey di kontri dey currently observe.

Oga Boss Mustapha, wey be di Secretary to di goment of di Federation (SGF) and Chairman of di Presidential Task Force (PTF) on COVID-19 na im tok dis one during di Task Force briefing for Abuja on Thursday.

D Presidential Task Force on COVID-19 also tell di aviation authorities and airline operators to begin di process for di reopening of international flights.

According to Sani Aliyu di National coordinator, PTF On COVID-19;

"For international travel, we don make recommendations to di aviation industry to commence di process for opening international airports, provided say all existing international and local prevention guidelines on Covid-19 dey in place"

"We don modify di advise with regard to arrival for flight. Passengers wey dey arrive di airport for domestic flight dey advise to arrive at least one and di half hours before di flight and three hours before international flight wen dem restart."

"For interstate travel, free movement for pipo and goods go continue but only outside di curfew hours."

E add say pipo must follow strict compliance to di guideline for transportation.

On Wednesday August 5, members of di Presidential Task Force on Covid-19 brief President, Muhammadu Buhari on dia plans to stop di spread of coronavirus and di way forward.

Nigeria

Wia dis foto come from, PTF on Covid-19

Di meeting happun inside di Presidential Villa, for Abuja and di chairman, Boss Mustapha, wey also be Secretary to di goment of di federation na im lead di PTF team.

Odas for di meeting na di PTF national coordinator, Sani Aliyu; di Minister of Health, Osagie Ehanire; and di Director-General of Nigeria Centre for Disease Control, Chikwe Ihekweazu.

Currently Nigeria get 44,433 cases of coronavirus for di kontri. 31,851 pipo don recover from di disease while 910 don die.

Di meeting dey come ahead of today announcement of new guidelines by the task force.

Oda tins wey di PTF on COVID-19 tok

Coronavirus coping

Wia dis foto come from, Sodiq Adelakun

  • For Industry and labour di main modification wey dem get na advise for banks to limit di number of customers within dia operating areas to 50% occupancy inside di banking halls in order to allow for physical distancing and limit dia workers to 75% or less but banking operation go continue as usual.
  • Dem extend working hours for goment and oda corporate offices to normal official hours from Monday to Friday with di mandatory use of non medical face masks.
  • Dem encourage work at home policy for civil/public servant below di grade level of 12
  • Essential staffs of grade level 12 and above maybe encourage to come to work
  • Dem go dey work with state authorities to enforce di wearing of facemasks for personalized services such as: hair salon, mechanic, artisans etc
  • No major changes for market apart from di mandatory wearing of facemask
  • Hotels fit continue to open but restaurant go continue to dey do take aways or delivery system until further notice.
  • Gyms, Cinemas and Night clubs go remain closed until further evaluation.
  • Dem don advise National Youth Service Corp to start planning ahead of resumption in future phase but no be within dis current phase of di response.
  • All daycares and primary schools go remain close until further evaluation. However, while primary schools dey closed, registered pupils fit proceed to take di national common entrance as soon as e dey possible, provided dem obey di covid-19 guidelines.
  • Secondary and Tertiary institution still remain closed, however dem don make arrangement for existing/graduating student for dia final years of secondary schools to resume and partake for dia exams in line with di guidelines wey Federal ministry of education issue.
  • No new changes for places of worship, di policy still remain di same.