PDP Primaries in Edo State: Gov. Godwin Obaseki win Edo PDP Primaries unopposed just three days afta e join Nigeria main opposition party

Wia dis foto come from, Godwin Obaseki/Facebook
Edo State Govnor, Godwin Obaseki don become PDP govnorship candidate for di Edo election wey go happun for September, 2020.Di Govnor return unopposed afta im only only rival for di primary election, Ken Imasuagbon, step down for am.
Obaseki win di Edo PDP Primaries unopposed just three days afta e join Nigeria main opposition party.
Imasuagbon, wey bin tok say im no go step down for Obaseki before di primary election announce im withdrawal just some minutes before di party primaries start.

Wia dis foto come from, Getty Images
Anoda arc rival of Obaseki for di PDP ticket, Engr. Gideon Ikhine bin step down earlier for di incumbent governor, wey comot from di All Progressive Congress (APC) wen di party disqualify am to contest for di primaries before im go join di opposition party, PDP, on Friday.
Even though Imasuagbon don step down from di contest wia 2,229 delegates go choose di PDP governorship flagbearer, di voting still happun to confam say na Godwin Obaseki be di PDP govnorship candidate.
So as e be so, stage don set for di battle between di main contenders for di 19 September, 2020 election wey be Pastor Ize Iyamu of di APC wey be di kontri goment party and Obaseki wey just port comot APC wia im win di 2016 election enta di PDP.







