Edo Govnorship primary: Wetin we sabi about why APC disqualify Edo Govnor, Godwin Obaseki

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Yemisi Lanre-Idowu
- Role, Senior Broadcast Journalist
Di ruling All Progressives Congress party, APC, for Nigeria don disqualify Edo state Governor, Godwin Obaseki from running in di 2020 Edo primary.
APC Screening Committee for Edo State Governorship election on Friday declare say Govnor Godwin Obaseki dey unqualified to contest in di election sake of say some wuruwuru dey im education certificates and NYSC.
Dem also two odas, Hon. Matthew Iduoroyekemwen and Egnr. Chris Ogiemwonyi.
But di committee clear Pastor Osagie Ize- Iyamu, Dr. Pius Odubu and Hon. Osaro Obazee.
Di screening committee bin announce di disqualification when dem present dia report to di Adams Oshiomhole-led National Working Committee for Abuja on Friday.
Chairman of di panel, Prof. Jonathan Ayuba, explain say Govnor Obaseki dey disqualified because di committee no fit vouch for di authenticity of im Higher School Certificate wey e claim but no fit produce am.
Di committee tok say di document wey e produce only show im attendance.
Di seven-man screening committee tok say di report dey conclusive and na all members of the panel sign am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Ayuba tok say di committee dey thorough for di process as dem record am and dem go make available di unedited recording to di party.
Meanwhile, Govnor Obaseki don react. E say inm no go appeal di outcome of di screening process, as im dey seek re-election into office.
For statement by im media aide, Crusoe Osagie, di govnor tok say e no need to file appeal as e be say na di National Chairman, Adams Oshiomhole start di move from di beginning.
E tell im supporters make dem stay calm, wait for im further move.
"We don watch di mockery of democratic process, which Comrade Adams Oshiomhole, dey administer and superintending over in our great party di All Progressives Congress (APC). E don dey unfortunate, disheartening and dreadful spectacle"
"We don initially know say going by di open display and enthronement of illegality by one man for di party wey comprise several organs and big big important pipo, there is no way that Governor Godwin Obaseki go get fair assessment for di run-up to di nomination of candidates wey go fly di flag of di party for di forthcoming Edo gubernatorial election". Im tok.










