Edo state news: Godwin Obaseki don join People's Democratic Party

Godwin Obaseki

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Edo Govnor, Godwin Obaseki
Read am in 1 mins

Edo state governor Godwin Obaseki don comot from di ruling All Progressive Congress go join di People's Democratic Party.

Chief Press Secretary Crusoe Osagie confam di tori to BBC Pidgin.

Governor obaseki bin formally announce im decision to resign e membership of di ruling APC party on Tuesday 16, June 2020 afta dem no allow am participate for di party governorship primaries.

Oga Osagie add say di governor "get plans to contest dis year gubernatorial election under di PDP"

Di party for dia social media account welcome di governor for inside post afta e pick up e membership card for di party secretariat for Benin City, di state capital.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Obaseki im sef for inside tweet say e move show e ambition to seek re-election as Governor of Edo state.

Im say "e always dey committed to bring good governance and sustainable development of our dear state."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2