You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Big Brother Cameroon: Why fans glad as Ranibel Kizzeey survive eviction
Afta three more housemates pack dia cargo komot, fans di glad, di praise Ranibel Kizzeey as e remain for Biggy mansion.
Melinda Swan, Brown Sugar and Nyanda Kelly march poto-poto afta floods for Douala rain go house.
Fan dem no miss Melinda Swan or Brown sugar, dey say deh deserve for komot. Den, fans no pity Kelly say e lie about e bornday.
Why fans glad as Ranibel remain
Some of dem say if Ranibel komot, Biggy mansion no go sweet again, as de housemate di add flavour for di mansion. Some laik Ranibel say e bi very natural.
Ranibel bi sleep for some kana way, open leg and di tok go up and down say e disgrace dem, so some fans bi wan make e komot.
But Ranibel na one of de people weh wans laik pass. Afta Nerisa weh e get army for fans weh deh vote quietly, na Ranibel wit plenti votes.
See de eight Biggy 237 housemates for eviction chair
As Biggy enta number three week, eight housemates be dey for hot eviction chair.
Housemates wey dey hot eviction chair bi Cindy, Kelly, Ranibel, Melinda, Aluan, Xexzy, Brown and Nerisa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nyanda Kelly, laik correct woman weh deh di eva celebrate birthday wen deh get new catch, tori for house say na e birthday sotei, chop free cake and free musician. But e explain say na drama deh act.
Ranibel Kizzey, na de housemate weh e sleep carelessly for house turn to tok of de town why e no wear 'colang' before e sleep. Tori for house na say e guy bi don chop eviction so e dan bi lonely.
Cyndy Stainless, dis housemate too quiet and just dey laik pap, flat, deh no di see e and e no di tok.
Melinda Swan too, no di hot or cool.
King Aluan na de trouble maker for house, all man for house di vex wit e, and more dan ten pipo nominate e for eviction.
Akere Nerisa weh e get top votes last week, also deh for eviction list, but de good tin na say e fans no di make noise, deh di just 'nyante' go vote.
Hexzy Val, Brown Sugar also dey for hot chair.
Dis week for biggy mansion bi hot, plenti gist, kissing bi dey house, Nerisa kiss Achiri Victor, and funny kweshion from Biggy, on de last taim de housemates 'nack kanda' or do kerewa.
Den de kana sleeping position for house weh e shake social media, Stanley Enow and Tzy Panchak visit Biggy mansion.