You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mamman Daura no travel go United Kingdom for treatment, e dey kampe - Bashir Ahmad
Read am in 1 mins
Afta plenty tok on top weda Mamman Daura still dey Nigeria abi e don fly go di United Kingdom on emergency treatment, latest informate be say oga Duara no go anywia.
Di Personal Assistant to Nigeria president Muhammadu Buhari on New Media, Bashir Ahmad, enta Twitter say make Nigerians ignore all di tori say im travel.
Oga Bashir say, truth no dey at all for all di plenty tok-tok as oga Daura dey kampe and im no travel go anywia.
Tori bin fly unpanda say di Presido powerful nephew bin go United Kingdom for emergency medical treatment.