Kim Kardashian Kanye West: Di American celebrity couple don re-unite afta divorce tweet, bi-polar instagram story 'palava'

Kanye West and Kim Kardashian West

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kim Kardashian (left) and Kanye West (right)
Read am in 3 mins

Popular reality TV superstar Kim Kardashain don return to her husband Kanye West, di ogbonge rapper enta social media yan some kain tins.

Kim bin fly from California go Wyoming to meet her husband for di first time afta some weeks.

Early dis month Kanye bin enta social media to post many different kain tins about im wife but later delete am.

Kim Kardashian Kanye West

Wia dis foto come from, Kanye West

Wetin we call dis foto, American rapper Kanye West na Kim Kardashian husband and US President Donald Trump friend.

For di tweets, im say im don dey try divorce her for two years now. Say dem almost remove di pregnancy of dia first pikin plus say im mother in-law Kris Jenner wit one doctor bin wan try lock am up.

Two day later, Kim sef enta social media to say Kanye get bipolar disorder.

She say, "many of una wey sabi Kanye know say in get bipolar disorder." She add say, "anybody wey get am or get pesin close to am wey get am sabi say e dey seriously compicated and difficult to understand."

Im later apologise to im wife for public as im post for Twitter say "I go like to appologise to my wife Kim sake of say i cari mata wey suppose be provate enta market."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Kim Kardashian Kanye West

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kim Kardashian and Kanye West

Wetin bin make Kim Kardashian and Kanye West clash?

America rapper Kanye West bin post for twitter for Wednesday morning of 22 July say im don dey try to divorce im wife, Kim Kardashian, wey be reality TV star, but he don later delete di tweet.

"I bin try to divorce Kim since she meet wit Meek for Warldolf Prison reform," West tweet and im no give more informate.

Kim Kardashian later admit in public for di first time say na bipolar disorder cause am.

She announce am for her Insgaram stories on dat same Wednesday afternoon wia she ask pipo to try understand say di mata don really affect she and and family reputation.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

For Monday night of 21 July, 2020, Oga West bin post some tweets wey im late delete, e claim say im wife dey try to lock am up on top health mata and because say im dey compare himself to Nelson Mandela.

All dis tins happun one day afta West launch im presidential campaign for Charleston, South Carolina. For that event, West tok how decision say make im wife no do abortion.

Im wife representative for that time no comment on top dis mata.

Di 43 year old rapper na former supporter of President Donald Trump, he don make pipo begin dey wonder if dis im presidential ambition na real or na anoda publicity stunt to take sell im album.

Before Kanye tie di knot wit Kim, im first wan marry designer Alexis Phifer wey im dey date since 2002.

Dem engage for 18 month before di two wey-for-be couple say dem no do again and scatter dia engagement.