Xenophobia: Goment go epp Nigerians wey dey return from South Africa with 'shikini' moni
Nigeria goment say dem go do wetin dem fit to helep all di pipo wey decide to return from South Africa.
Chairman/Chief Executive officer of Nigeria in Diaspora Commission Abike Dabiri-Erewa, say goment go try small to tackle di immediate wahala wey di returnees go face.
According to her, di major problem wey dem dey see wen di pipo return na communication. So to solve dis wahala, goment go give all of dem sim cards wit airtime wey go last for at least two months so dem go fit reach dem.
To also help dem start fresh, Bank of Industry (BOI) go also dey ground to offer dem entrepreneurship program
E no end dia, she say dem go provide dem wit small transport moni wey go cari dem go back home, and dem go also provide dem wit shikini moni to to start business.

Wia dis foto come from, Nigeria Ministry of Foreign Affairs
Wetin we sabi so far
Nigerians wey dey return from South Africa don begin board afta hours of delay.
Na 178 pipo confam dey inside plane wey go soon leave for Lagos, Nigeria.
Di Air Peace flight wey suppose bring back di returnees from South Africa bin dey delayed as SA authorities begin immigration process all ova again.
End of Di one wey oda users dey read well well
According to madam Dabiri-Erewa, say, Air Peace flight bin don dey ground since early momo but South Africa Immigration pipo na dem delay.
She say, South Africa authorities bin dey ask for anoda round of immigration procedure, so dem gatz start all over again
Initially na more dan 317 pipo name dey manifest and 83 of dem na women, e neva clear why na only 178 dey return.













