Lagos: Why police block part of Third Mainland Bridge

Side view of di bridge.
Wetin we call dis foto, Na 1990 federal goment open di Third Mainland bridge wey dem build from 1986
Read am in 1 mins

Third Mainland Bridge from Lagos Mainland to island been dey block on Wednesday morning because of fire, according to authorities.

Adesina Tiamiyu wey be oga of Lagos State Emergency Management Agency confam di tori give BBC Pidgin say di bridge been close for some time afta one van catch fire.

Wetin happun make go slow wey wear 'agbada' tanda from Owonsonshiki area to Island on top di bridge even as authorities dey work on am.

Lagos State Emergency Management Agency's response unit post wetin do make authorities shut down di bridge for tweeter.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Tiamiyu tok dem bin close some of di lanes for Owonsonshiki area to Island side of di bridge to avoid wahala, but afta dem quench di fire, di whole road don clear.

Di mata bin happun around 7 O'clock on Wednesday morning.

Third mainland bridge be di longest bridge inside di whole Nigeria.