You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Manchester United sama Manchester City 2-1 to lift FA Cup trophy
Manchester United don win di 2023/2024 FA Cup afta dem sama rival Manchester City 2-1 for Wembley Stadium on Saturday, May 25.
Alejandro Garnacho put di Red Devils ahead wit a close-range effort for di 30th minute afta a mix-up between City defender Josko Gvardiol and goalkeeper Stefan Ortega.
Kobbie Mainoo den double United lead nine minutes later wit one ogbonge finish.
No be just di FA Cup trophy be Manchester United prize for dis win, dem go also play European football next season as dem go into di Europa League.
Match highlights
Second half
FULL-TIME: MANCHESTER UNITED DON WIN FA CUP!
90+7 mins: Manchester United try pursue di ball comot Jeremy Doku cross and dem be break on. Manchester United get free kick.
90+6 mins: Manchester City fans bin wan happy say dia side get corner but di touch dey off.
90+3 mins: Manchester United don change Scott McTominay and Alejandro Garnacho for Victor Lindelof and Mason Mount.
End of Di one wey oda users dey read well well
90+3 mins: Manchester City don dey give di ball to Jeremy Doku everytime dem get du ball. E try pass am to Aaron Wan Bissaka but Andre Onna comot di corner kick dat pass cause.
90+1 mins: Manuel Akanji shoot ball from far but e no work. Dia be 7 mins of injury time, e fit change dis match so?
89 Mins: GOALLL!!! Jeremy Doku don score di first goal for Manchester City for dis match.
86 mins: Di ball bin dey played wide to Jeremy Doku and im low ball clear by Scott McTominay.
85 mins: Phil Foden dey blocked by Sofyan Amrabat and City get anoda free-kick.
84 mins: E be like Sir Alex Ferguson dey fear now as Manchester United still dey di lead.
82 mins: Andre Onana don try for dis game sha! E punch Phil Foden corner troway.
81 mins: Bruno Fernandes beat di wall but im shot land directly inside Stefan Ortega hand.
79 mins: Di wall comot City free-kick troway.
78 mins: Jeremy Doku foul Sofyan Amrabat just outside di box and Manchester City get free kick.
76 mins: Kyle Walker get anoda pop from range on for Andre Onana save by pushing am to push am away wit anoda hand.
74 mins: Manchester City play dia corner but Diogo Dalot head am behind.
72 mins: Manchester United don make substitution as Jonny Evans and Rasmus Hojlund dey come in and Lisandro Martinez and Marcus Rashford dey comot.
68 mins: Alejandro Garnacho bin wan go for goal for imself. So close!
64 mins: Soo close for Manchester City! Julian Alvarez shot bin go wide.
61 mins: Manchester City don raise pressure as dem don dey try score dia own goal back.
60 mins: Beta save by Andre Onana as Kyle Walker try score goal.
56 mins: Manchester City don win dia first corner of di game but Andre Onana push out Kevin de Bruyne play. de mdon change Kevin out for Julian Alvarez sha.
55 mins: Erling Haaland give beta strike even thogh we neva hear much for dis match.
53 mins: Penalty appeal for Manchester City as Scott McTominay fall down.
52 mins: We neva see change in play but Manchester City dey try go through di middle of Manchester United defence wey dey make Pep Guardiola to dey frustrated.
50 mins: Erling Haaland pursue Andre Onana on di ball but di Manchester United keeperjust clear am comot.
48 mins: Manchester United play long again wey make Marcus Rashford pursue di ball even pass Kyle Walker but no give am beta touch.
46 mins: Pep Guardiola don make some replacements. Manuel Akanji and Jeremy Doku replace Mateo Kovacic and Nathan Ake.
First Half
45+1 mins: Kevin de Bruyne kick ball enta box no bodi dey to chook am for net.
45 mins: YELLOW CARD! Kobbie Mainoo don collect as e fly late on Kevin de Bruyne. Wit 2 minutes added time
43 mins: Manchester United neva give Manchester City space and don dey punish dem for all dia defence kasala.
41 mins: Pep Guardiola temper don dey rise as Manchester City no dey play dia best game for hia
39 mins: Kobbie Mainoo don score Manchester United second goal of di FA Cup finals.
37 mins: Disallowed goal as Marchis Rashford score offside.
33 mins: GOOOALLLLLL!!!! Alejandro Garnacho give Manchester United dia first goal of di match as di first teen to score for Manchester United since 2004.
25 mins: Mateo Kovacic burst enta box cut from back to di middle but Kobbie Mainoo reach am bifor any Manchester City player.
23 mins: Nathan Ake defend Alejandro Garnacho well as im bin try to pass am for di right of di box but Ake carry im strength to get goal kick.
21 mins: Manchester City really dey mess up as Stephan Ortega bin play poor ball inside im box. Mateo Kovacic beat Bruno Fernandez to ball and comot dancer.
17 mins: Bernardo Silva try play di ball give Phil Foden but Diogo Dalot catch di pass for middle wey turn am to goal kick.
15 mins: Manchester United fit jolly wit di way dem start dis match. Dem get free kick wey Kevin de Bruyne life well but Raphael Varane bin head am troway.
13 mins: Raphael Varane defend Mateo Kovavic ball well to pass ova di bar as Kevin de Bruyne bin dey pursue am.
11 mins: Bruno Fernandes don switch positions to put Marcus Rashford back to di middle of di field to keep City defence for dia toes.
9 mins: Machester City don do dia own back as Phil Foden carry Bernardo Silva ball go back post.
8 mins: Machester United don see chance to build attack as Bruno Fernandes carry di ball go di right side of di box for Alejandro Garnacho wey shoot di ball straight give Stefan Ortega.
5 mins: Manchester United no fit just grab di ball. E come make am look like say Pep Guardiola move to no wia hoodie instead to wear ogbonge suit na im vein, as most of di action dey happun for Manchester United half.
4 mins: Manchester United players don fall back as City players don dey dominate. Pep Guardiola side try dey open some gaps.
3 mins: Manchester City fans don dey hala for penality afta Erling Haaland fall for di 18 box as im dey try drag ball wit Lisandro Martínez but VAR no gree.
2 mins: Manchester United fit take early lead as Marcus Rashford try enta di defence byut Manchester City block ma well.
Match Preview
Manchester City and Manchester United go meet for di FA Cup final on Saturday, 25 May, and one team dey look to create more history and di oda dey attempt to salvage somtin from a miserable season.
Pep Guardiola's City wan follow up last Sunday title triumph by sealing a Premier League-FA Cup domestic double in front of a sell-out Wembley crowd.
United head to di national stadium wit speculation about manager Erik ten Hag future afta dia worst Premier League finish, as some of dia fans "dread" di showpiece final.
Ten Hag side bin finish eighth for di table, 31 points behind champions City, and gatz win otherwise dem go miss out on playing for Europe next season.
"I come here to win trophies," United boss tok. Im bin secure di Carabao Cup for im first season in charge.
"E dey all about winning trophies and we get opportunity to win two trophies in two seasons."
"Di FA Cup final na big event and we dey dia. We gatz go for am."
Man City vs Man Utd team news
For Man City, Ederson dey ruled out but Guardiola fit don swap out im first-choice goalkeeper for cup specialist Stefan Ortega anyway.
Mateo Kovacic and Nathan Ake go look to make dia case in training afta dem sit for bench for di win ova West Ham.
Raphael Varane and Lisandro Martinez return for United on di final weekend of di league season so dem fit dey reintroduced as di starting defensive partnership for Wembley.
Harry Maguire and Luke Shaw don lose dia race to dey fit but Ten Hag don confirm say Mason Mount, Anthony Martial and Victor Lindelof dey set to dey available afta dia injuries.
Head to head
City bin win seven of di last nine Manchester derbies across all competitions, including three in a row.
Dem win both Premier League meetings dis season, 3-0 at Old Trafford for November and come from behind to win 3-1 at di Etihad for March tanks to Phil Foden.
Man City win: 61
Manchester United win: 78
Draws: 53
Man City vs Man Utd first XI
Sutton FA Cup final prediction
Di 143rd FA Cup final na all Manchester affair, defending champions City go play 12-time winners United, but who go lift di famous trophy dis weekend?
We ask BBC Sport football expert Chris Sutton for im prediction, as well as some famous fans of both teams.
"Nobodi really feel say Manchester United go beat Manchester City," Sutton tok. "United dey hope say dem fit win, wey go dey different, but evidence no suggest say dat kain tin fit happun."
You gree? From one Blues perspective, Blossoms frontman Tom Ogden and Better Joy Bria Keely tok dia mind.
Na Blitz Vega guitarist Kav Sandhu give di Red Devils point of view.
Man City v Man Utd (3pm West African Time)
Chris Sutton: Bruno Fernandes na key player for United. I bin criticise am bifor but if im play, at least dem go dey dangerous against di Premier League champions.
United get oda players who, if dem get dia moments, fit hurt City but evribodi know how dis game go play out – di only way United fit win na if dem play counter-attack.
Dem no go go toe to toe wit City, dem no fit. Maybe dis na Erik ten Hag last stand.
Blitz Vega guitarist and United fan Kav say: Bruno na our best player dis season and we miss am since im dey out of di team. A lot of pipo dey criticise am , but im be one player wey fit make di difference on Saturday.
I no dey sure about Ten Hag, but I no tink say options plenty outside. Obviously if Don Carlo [Ancelotti] dey available, I go bring am in for a couple of seasons, but I feel say e dey more important we clear out di players wey no suppose dey dia.
Wit di new infrastructure, Dem suppose give Ten Hag anoda season, but witout di responsibility of signing players.
Chris Sutton: I dey pity Ten Hag becos im United team for back no plenty sake of injuries, but di koko be say im go likely leave di club dis summer.
Mauricio Pochettino leaving Chelsea don open up anoda window for United becos I no feel say anyone dey sure who Sir Jim Ratcliffe Ineos Group dey target - or if dem dey even target anybodi - but to me e still look like dis go be Ten Hag last game as United manager.
Better Joy Bria Keely: E go make sense well-well to get di Double afta last season Treble, and keep di city blue! na always fun - mostly for us – to watch am wit friends and family wey be United fans - some of dem no dey easy to wind up!
Chris Sutton: Wen di season start, di tok na about United getting closer to City afta dem bin finish 14 points behind dem for 2022-23. E bin dey logical but di gap don big well-well and grow to 31 points.
Ten Hag bin make progress for im first year on di job but dem don fall well-well dis time.
Im tok a couple of weeks back say United na one of di most entertaining and dynamic teams to watch for Premier League - dat na rubbish. Wit di greatest respect to am, I no know wetin im dey tok about.
Dem don fall and go back, and evribodi fit see am. United fit somehow win dis one-off game, but big gap dey between di two teams even if dem do.
Chris Sutton say: Wetin Pep Guardiola don do for City dey remarkable, and not just becos of how much im don win. Im dey so adaptable, season afta season, wit di way im don change di team so dem fit play a slightly different way each time.
Blossoms frontman and City fan Tom Ogden say: At di moment, City best player gatz be Phil Foden, we all dey tok about im potential for di last few years, and I feel say dis season im really deliver. In di absence of Kevin de Bruyne, Phil step up and im dey unbelievable.
Better Joy's Bria Keely say: Foden na world class and im dey so silky smooth! Im dey always deliver under pressure so im go make di difference for us on Saturday.
Chris Sutton: Look, United get chance, na puncher chance, if City get off day and dem miss opportunities and if Andre Onana play well - but di United players go need to raise dia game to a level wey we neva see bifor dis season.
For any given game, di question na if United get di players, di team and di set-up to compete wit City? You go say say if dem play each oda 100 times, you go fancy City in probably 95 of dem, if not more. Dat na how good dem be.
Chris Sutton say: Di only tin wey probably fit stop City na if dem kotinu to do party afa dem win di Premier League on Sunday. Dem look like say dem dey in form.
Wen dem bin meet for last year FA Cup final, City bin carry di Champions League final for mind as well. Dis time, dis na dia last game so City fit give am dia all - and den carry on celebrating.
Blossoms frontman and City fan Tom Ogden say: City go win. Just from seeing di momentum di team don gada during dis final few weeks of di seasons, and also wit di disappointment of di Champions League exit, dem go wan be di first team to do di League and FA Cup Double for di second time in a row!
Blitz Vega guitarist and United fan Kav say: E dey hard to look past City. Dem get incredible team wey always dey deliver. Dem be winners; exceptional players wey get winning focus wey one of di greatest mangers don put for dia bodi.
Dis na FA Cup sha, and if dis United players get any pride, even if na just becos dem dey fight to get move somwia else, dem get di potential to win. My head say City, but I go go wit my heart!
Better Joy's Bria Keely say: Silly question, really - obviously City go win. We too good under pressure.
Chris Sutton say: If City lose, e go be one of di biggest FA Cup shocks eva, and yet dis na di mighty Manchester United wey dey try to cause am.
I know say e sound ridiculous, and you fit call me idiot if you like, I no mind... but if you tink about wetin City dey like for dis situations, e go be huge shock, abi?
We know dia mindset and we don see how dem dey kotinu to win wen dem dey on di home stretch to di Premier League title race. Dis dey exactly di same.
Wetin make am sweet na say na one-off game and na derby, becos evri one dey tok about di magic of di FA Cup for scenarios like dis but wen you check am well-well, di koko be say na only one team fit win.