Otti reveal how e discover over 80 deadi body, 20 headless body dem for Abia

Wia dis foto come from, Abia State Government/Facebook
Abia state goment for South east Nigeria say dem recover 80 deadi body dem from kidnappers through security intelligence informate.
Govnor Alex Otti say security informate wey dem bin get bin show say all di ransom or money wey family of kidnapped victims bin dey pay kidnapers, na for Umuchieze Cattle Market, wey dey for Lokpanta, Umunneochi local goment area.
Otti tok dis one during im monthly media chat wey dem call "Governor Alex Otti Speaks to Abians", for Goment House Umuahia.
E say, dem bin discover di body dem afta dem put electronic equipment for different parts of di state.
“We put electronic equipment to find out wetin dey happun for different parts of di state. Few weeks ago, we find say many of di ransom wey pipo dey pay for kidnapping dey end up somewia or Umunneochi LGA,” Otti tok.
Different kind of criminal activities including prostitution, sale of hard drugs, kidnapping and armed robbery dey occur for di Lokpanta Cattle Market area.
Dis na why di Abia state goment bin find am necessary to raid di market, destroy some of di brothel.
During di raid, di goment say, “wetin we bin find shock us.”
End of Di one wey oda users dey read well well
Di raid no even reach two days before dem “discover over 80 deadi bodi around di cattle market, and we recover 20 headless bodies, bodies wey don dey rotten wey include women and children,” Govnor Otti tok.
“We recover skeletons wey we no fit count finish of pipo wey dem kill and leave to rotten, still around di area,” e add.
Otti say im goment no go put dia hand or support any kain insecurity and dat na why im order make di Lokpanta market become only daily market wey go open by 6am and close by 6pm.
Di goment also say dem go fence di market so dat dem go fit provide adequate security.
E come add say di market go now become general market, no more cattle market as dem go now begin sell oda tins for di market but dem go still get section for cow sellers.
Di goment say “remember say wen we see di skeletons, we no sabi which skeleton belong to any ethnic group".
So far di goment never do any arrests as Oga Otti say dem still dey torchlight to know di pipo wey get hand for di crime.
But e say “I fit assure you say Umunneochi dey calm.














