How Indonesia use blended palm oil fuel take fly dia commercial flight

Wia dis foto come from, Getty Images
Indonesia don fly dia first commercial flight wey dem use palm oil-blended jet fuel.
Dis na as di world biggest producer of palm oil dey ginger make dem use more biofuels to cut fuel importation.
Na di Garuda Indonesia run di Boeing 737-800NG aircraft wey use di blend to carry ova 100 passengers from di capital Jakarta go Surakarta city, according to di Garuda Indonesia CEO Irfan Setiaputra.
Di Indonesian State Energy Firm PT Pertamina (PERTM.UL) na dem produce di palm oil blended jet fuel.
Dem use hydro-processed esters and fatty acid (HEFA) technology to make refined bleached deodorized palm kernel oil.

Wia dis foto come from, Getty Images
Reuters report say Garuda bin run plenti tests including flight test on di new fuel earlier dis month and engine ground test for August.
Pertamina don tok say di palm based fuel dey reduce less greenhouse gases compared to fossil fuel.
Palm oil producing kontris also say make dem include oil wey pipo dey use cook for di feedstock for di production of sustainable aviation fuel (SAF).
End of Di one wey oda users dey read well well
Harris Yahya wey be one director for di Energy Ministry say di use of biofuel go reduce di greenhouse effect.
For 2021, Indonesia bin run one test flight wit di same fuel on one aircraft wey state-owned Dirgantara Indonesia get, di plane fly from di city of Bandung for West Java go di capital Jakarta.
Di aviation industry wey be one of di biggest emitter of greenhouse gases dey find way to cut carbon footprint with alternative fuels.
Sabi pipo say di industry go need 450 billion litres of SAF a year by 2050 if di fuel go fit balance di amount needed to achieve net-zero target.
But some kontris don dey hala ova di kain deforestation wey production of palm oil from plantations go fit cause.
Di European Union don already impose import restrictions on palm oil.
Already for April 2022, Indonesia bin ban export of any kind of palm oil wit immediate effect.
Oda fuel alternatives wey aviation dey look into

Wia dis foto come from, Getty Images
Ova di last 20 years or so, dem don dey use biodiesel from animal wastes from dead animals for di UK don grow.
New research say e don grow ova fortyfold since 2006.
Most of dis fuels dey used for cars and trucks but UK and EU goments dey try increase di use of dis kain waste to take make aviation greener.
According to Transport & Environment, flight from Paris go New York go take di fat of 8,800 dead pigs if all di fuel come from animals.
So many sources from di pipo wey dey use animal fats for biodiesel and di pipo wey dey carry animal wastes take make dog food, tok say if di aviation industry enta dis market to reduce di footprint, e go cause scarcity for di product from di oda pipo wey dey use am.














