Meet di most powerful black pesin for UK

Wia dis foto come from, JPG Photography
Powerlist 2024 don name di editor-in-chief of British Vogue, Edward Enninful OBE, as di most influential black pesin for di UK.
Powerful Media annual list dey always celebrate pipo wey get African, African Caribbean and African American heritage.
Now for dia 18th year, dem draw di attention of black role models give young pipo.
Oda names wey make di list for 2024 include Afua Kyei, Bank of England chief financial officer, and Dragon Den star and podcaster Steven Bartlett.
Enninful na di first black man to serve as oga patapata for di British fashion magazine but earlier dis year, e bin announce say im go step down so dat im go help grow di brand globally and focus on oda projects.
Enniful na also di European editorial director of Condé Nast.
Di 51-year-old describe am as honour to be number one on di list, wey e tok say dey "shine light on black pipo wey dey really break boundaries, wey no dey fear and dey champion wetin e mean to be truly diverse for dia own industries".
Who be Edward Enninful?

Wia dis foto come from, JPG Photography
Dem born am for Ghana, Enninful move go London wen e still dey small wit im parents and six siblings. As a teenager, e do modelling for some time. E briefly model for Arena and i-D magazines before assisting stylists Simon Foxton and Beth Summers on fashion shoots.
End of Di one wey oda users dey read well well
E start im editorial career as fashion director of British youth culture magazine i-D at di age of 18, wey make am di youngest pesin to be become editor of a major international fashion title.
Enninful ogbonge bin work on Italian Vogue for 1998, American Vogue, since 2006, and W Magazine, since 2011. Dis lead to im appointment for British Vogue for 2017.
Dem confam am as di new editor-in-chief of British Vogue on 10 April 2017 and e be di first black pesin to occupy dat position for di magazine history.
Since im appointment, di magazine don feature British mixed-race model and feminist activist Adwoa Aboah plus di likes of Beyoncé, Oprah Winfrey, Rihanna, Judi Dench, Madonna and soccer player Marcus Rashford.
Di September 2019 edition, guest-edited by Meghan, Duchess of Sussex, bin feature 15 female changemakers and e be British Vogue fastest-selling for dia 104-year history.
For 2014, di British Fashion Council name Enninful as di fashion creator of di year.
Dem honour am wit an OBE for 2016 for Services to Diversity for di Fashion industry, and for 2018, di Council of Fashion Designers America award am wit di Media Award
For 2019, The Daily Front Row for Magazine of di Year honour Enninful and list am as one of di Evening Standard top 20 most influential Londoners of 2019.
Tunde Olarenwaju, Afua Kyei and odas wey make di list
The Powerlist dey recognise men and women across a wide range of industries including business, science, technology and di arts.
Oda names for 2024 include Lord Woolley of Woodford, co-founder of Operation Black Vote and principal at Cambridge University Homerton College, as well as model and activist Munroe Bergdorf.
Comedian Mo Gilligan and entrepreneur Patricia Bright also show.
Oda pipo wey don make number one spot before include Jacky Wright, former chief digital officer and corporate vice-president at Microsoft US, seven-time Formula One champion Sir Lewis Hamilton and former Children's Laureate Malorie Blackman.
- Edward Enninful, OBE - editor-in-chief of British Vogue, European editorial director of Vogue
- Dean Forbes - CEO, Forterro, Partner Corten Capital
- Afua Kyei - chief financial officer, Bank of England
- Marvin Rees - mayor of Bristol
- Tunde Olanrewaju - senior partner and managing partner, McKinsey & Company
- Joshua Siaw, MBE - partner, White & Case
- Syreeta Brown - group chief people and communications officer, Virgin Money UK
- Paulette Simpson, CBE - executive, corporate affairs and public policy, Jamaica National Bank; executive director, The Voice Media Group
- Vanessa Kingori, CBE - chief business officer, Condé Britain, Vogue European business advisor
- Lord Woolley of Woodford - co-founder, Operation Black Vote, and principal, Homerton College, Cambridge University















