Hospitals no need police report to treat gunshot wounds - IGP

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Inspector General of Police, Kayode Adeolu Egbetokun don issue order give medical practitioners for di kontri say make dem give urgent treatment to victims of gunshots and accidents weda dem get police report or not.
For statement wey di Police PRO, Olumuyiwa Adejobi issue, e tok say "dis dey come in response to di sad loss of life wey dey happun sake of di neglect of gunshot and accident victims."
Di directive na to make sure say di Compulsory Treatment and Care for Victims of Gunshot Act of 2017 dey fully enforced.
Di Act mandate all healthcare providers to put di immediate care and stabilization of di patients first sake of say timely medical attention fit save lives.
Many pipo don come on top social media to chook mouth for inside dis new directive.
Former Senate President Bukola Saraki chook mouth say di enforcement na victory for one Linda Igwetu, wey be youth corp member wey die afta police shoot am for 2018.
E say, "I remember say I call Linda family afta she die and I promise dem say we go work to make sure say her death no dey in vain. Wit dis new policy wey di IGP don take, di kontri don take major step to fulfil dat promise."
Reports of pipo wey dem no treat for hospital say dem no get police report don dey very rampant ova di last few years.
End of Di one wey oda users dey read well well
One of di most recent tori na dat of Greatness Olorunfemi, wey die from di injuries she get from di attack of ‘one chance’ operators for Abuja for September 2023.
According to reports, Ms Olorunfemi, wey be community developer, die for Maitama General Hospital for di federal capital, wia dem rush her go afta di attack wey happun along Katampe-Kubwa road.
Tori tok say her attackers bin throw her out of one fast-moving vehicle on her way from work.
Tori bin go viral on social media say di hospital no attend to her 20 mins afta dem rush her go there.
Reports allege say di hospital bin request for police report before dem go fit attend to her, development wey allegedly lead to her death.
However di hospital management don clear am say Ms Olorunfemi don die by di time dem bring her come di hospital.
How Nigerians dey react to di directive?
Tori don comot say dis rule wey don dey in place since, so wetin go change?
Former IGP Mohammed Adamu for inside interview wit Channels TV bin say di same tin, "save life first, even if di pesin na armed robber, kidnapper or bandit and e get gunshot go hospital, make dem save im life first, before tinking wetin to do next, no issue dey of police report before you treat anybodi for gunshot."
So worry dey say dis policy no go catch as even for 2021, di IGP don tok dis tin for inside interview.
Pipo don dey suggest plenty ways wey di policy go fit work for social media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2












