Families dey do private burials for victims of deadly Niger bandits attack

Wia dis foto come from, Zakaria Kontagora
Families of victims wey die for di bandits attack on Kasuwan-Daji village, Niger State don begin do private burials for dia deadi body dem.
Dis attack happun for Saturday 3 January 2026 for Demo village near Kabe District, Niger State wia dem more dan 30 pipo.
According to source wey dey near di village, na local vigilantes and few police officers dey around di area.
Also, di source tell BBC News Pidgin say di community and di pipo still dey in shock sake of di attack wey hit dia area.
Families don dey alreadi bury dia dead privately, instead of di mass burial wey some dey expect.
"Di community dey for fear and pain afta counting so many dead pipo and later realise say dem kill some oda pipo for dia room wey no dey di first set of pipo wey dem count dead.
"Di community dey in shock, nothing much dey go on for dia. Wetin you go see na local vigilante and few police officers wey dem station few kilometres to di place."
For Saturday 3 January 2025 police for Niger State confam say bandits attack Kasuwan-Daji village around 4:30 pm.
"Suspected bandits for National Park Forest along Kabe District, invade Kasuwan-Daji wey dey for Demo Village via Kabe, Dem burn di market, loot shops and carry items.
BBC News Pidgin gada say na market day wia plenti pipo come buy and sell wen di attack happun, di bandits also kidnap some pipo while ova 30 victims lose dia lives.
One eyewitness Marcus Philips Adoka give account of how di attack take hapun.
"Dis tin hapun here for Kasuwan Daji around 5-6 pm. Bandits enta di village and wreak havoc. Dem burn houses, kill many pipo. We no get security men here."
Anoda eyewitness say according to di reports wey im get from di village, dem shoot many pipo and dem tie dem wit ropes and later slaughter dem like goats and chickens.
"As you dey see for hia, dem slaughter pipo and deadibodi of pipo wey dem kill for forest dey too, dem dey recover dem one by one."
Why families dey do private burials for dia dead bodies
BBC News Pidgin gada say some families dey carry dia dead bodies to go bury on dia own instead of di mass burial wey di community bin plan.
Our source confam say di community get mixed religion of Muslims and Christians and some of dem just need to sharply bury dia dead.
"Some families don begin dey bury dia dead, especially di Muslims and few oda Christians but na just few families neva bury dia own, alot of families don bury dia dead."
BBC News Pidgin gada say di reason why some families begin bury dia dead bodies privately, na sake of di different places wey di pipo come from and dem gatz return di bodies to dia town bifor dem go fit do any burial for dem.
"Dem be from different faith and different communities, na market day and some of di pipo wey dem kill just come for market business to buy or sell."
"Some communities gatz transport dia dead bodies back home, some say dem go gatz wait for oda family members to come bifor dem bury dia dead relatives, so some just dig grave and bury dia pipo."
We gada say some families dey wait for oda family members bifor dem go fit bury dia dead, and some oda families no fit wait for di mass burial to happun.
Anoda reason na also becos say space no dey to keep dead bodies for dat area, and some religion gatz bury dia dead sharply.
"E dey difficult to keep dead bodies for more dan 24 hours becos place no dey to keep and preserve di body."









