How Nigeria police gbab 20 pipo for alleged attempt to take ova state secretariat

Members of Yoruba Nation separatist group wey police arrest

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Di Oyo State goment secretariat bin come under attack on Saturday morning, as one group of alleged jaguda pipo bin try take ova di di goment offices by force.

Di suspect wey di Oyo State Police Command say na suspected members of one separatist group, Yoruba Nation Agitation Group, bin attempt attack around 9:15 am.

Di police say di say na di collabo between dem plus oda security agencies bin scata di attack, afta dem bin get one informate about wetin wan happun.

Machetes wey police seize from di separatist group

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Wetin we call dis foto, Some of di weapons police say di suspects carry

Inside one statement wey di Oyo police tok-tok pesin, Osifeso Adewale, bin send to BBC News Pidgin, e say di suspects bin wear military uniform plus carry plenty weapons inside one unregistered Silver coloured Nissan Urban Caravan bus.

Di bus bin carry weapons like cutlass, pumpaction gun, bullets, assorted charms and an O'dua Nation agitation flag, police tok.

Police say dem arrest 20 suspects as dem wan commit di “unpatriotic”, “treasonable felony & terrorism”.

As part of measure to prevent dis kain tin from hapuning again, di state police command don ask area pipo make dm dey follow dem corporate wit any informate wey go help dem deal wit di criminal elements.

Di police no tok why di group wan kolobi di state secretariat.

items wey police seize from di separatist group

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Wetin we call dis foto, Some items wey police say dem recova from di suspects

Dis no be di first time wey police go dey make dis kain arrest.

for May 2023, Nigeria police arrest five suspected Yoruba nation members wey bin try to take ova broadcast activities for Amuludun FM one early Sunday morning, for di state capital, Ibadan.

Di suspect allegedly invade di radio station to show say dem dey provoke say di station refuse to regularly broadcast dia activities.

Bullets wey police seize

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Wetin we call dis foto, Bullets wey police say dem recova from di suspects