Wetin cause Ibadan explosion wey don lead to deaths, injuries, destruction - Govnor Makinde

Ibadan explosion

Wia dis foto come from, NEMA/UGC

Fear hold di pipo of Ibadan, di Oyo state capital South West Nigeria on Tuesday night afta one ogbonge explosion hit di city.

Di explosion wey happun for Adeyi Avenue, Bodija Estate area of di city shake many parts up to 15km stretch.

Di explosion affect Ologuneru, Apete, New Garage, Bashorun, Akobo, Sango and Eleyele.

Many videos of di effect of di explosion don spread for social media. Videos get different accounts of wetin happun and how bad e be.

One eyewitness for one of di videos tok say houses and cars wey far from di scene of di explosion also dey seriously affected by di blast.

“We hear a loud bang around 07:30pm. Dominos scata, Ace Mall for Bodija destroy,” di man tok.

On Tuesday night police say dem neva fit confam wetin happun.

Di Oyo State police tok-tok pesin Wale Osifeso tell BBC News Pidgin say di explosion happun around Dejo Oyelese Street, Bodija, around 7:44pm.

“Di cause of the explosion dey unknown.

“Number of dead and injured still dey unknown as search dey kontinu,” Osifeso tok.

Nigerian medical doctor and social media influencer, Dr Chinonso Egemba urge medical personnel for Ibadan and places wey near say make dem mobilise go Adeyi Avenue, Bodija, sake of say victims of di explosion need dia help.

“If you be medical personnel for Ibadan & close by, please your help & assistance dey needed for Adeyi Avenue, Bodija.

“Casualties dey dia. Please help RT,” Dr Chinonso wit di X handle @aproko_doctor bin tweet.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Effect of di Ibadan explosion wey happun on Tuesday night

Wia dis foto come from, NEMA

Wetin we call dis foto, Effect of di Ibadan explosion wey happun on Tuesday night
Effect of di Ibadan explosion wey happun on Tuesday night

Wia dis foto come from, NEMA

Effect of di Ibadan explosion wey happun on Tuesday night

Wia dis foto come from, NEMA

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Di National emergency management agency (Nema) say all relevant agencies of goment don dey alert for rescue operations.

Di South west zonal office for update dem post on Facebook say di "police, DSS, civil defence, Red Cross, Fire service including di local security outfit, Amotekun go follow for di operations wey go start Wednesday morning."

Late inside di night di Oyo State governor Seyi Makinde tok say na di activities of criminals cause di explosion.

Oga Makinde reveal say two pipo don die from di informate wey im get and 77 pipo don wunjure.

Di govnor tok dis one wen e lead goment officials go di scene of di incident wey don destabilize di state.

Govnor Makinde add say di explosion bin cause death and injury to residents of di state and im don deploy relevant agencies to begin rescue operations.

"In total, 77 injured victims don dey so far and dem don collect treatment. Two deaths bin dey and make dia soul rest in peace," di govnor tok

Govnor Makinde add say di goment to pay medical bills of pipo wey dey affected and dem go provide temporary accommodation for doz wey dia houses don destroy.

Effect of di Ibadan explosion wey happun on Tuesday night

Wia dis foto come from, NEMA

Effect of di Ibadan explosion wey happun on Tuesday night

Wia dis foto come from, NEMA