Police identify Sydney stabbing suspect wey kill six pipo and injure four-month-old baby

Joel Cauchi

Wia dis foto come from, Supplied

Australia police don identify di man wey stab six pipo to death for one Sydney shopping centre.

Police bin shoot and kill Joel Cauchi, 40, afta im cause serious panic for di pipo wey bin dey Westfield Bondi Junction complex on Saturday, 13 April.

Cauchi bin enta di complex and begin stab pipo wit large knife.

Five women and one man die. Many odas plus one baby injure.

Authorities say di attack fit dey "related to di mental health" of Cauchi.

Wen dem ask her weda im bin dey target women, New South Wales Police Commissioner Karen Webb tell tori pipo on Sunday say na "an obvious line of inquiry".

But she add say dem no go describe di stabbing as "act of terror", kon add say police no believe say e get any "ideological motivation".

Police bin sabi Cauchi, but dem no eva arrest am or charge am for im home state of Queensland.

Di first time wen hospital discova say im get mental sickness na wen in dey 17 years, Queensland Police say.

Im family describe im action as "horrific" and say im get mental health issues "since im be teenager", according to statement wey dem release through Queensland Police.

Di Cauchi family say: "We dey absolutely devastated by di traumatic events wey happun for Sydney yesterday (Saturday 13 April).

"Our thoughts and prayers dey wit families and friends of di victims and di ones wey still dey hospital for treatment at dis time.

"Joel actions bin dey truly horrific, and we still dey try comprehend wetin don happun."

Dem add say dem dey communicate wit di police and “no get any issue” wit di officer wey shoot Cauchi.

"She bin just dey do her job to protect odas and we hope say she dey cope alright."

NSW Police say dem neva still find di possible reason why Cauchi carry out dat attack.

Authorities say dem still dey try to notify families of di victims, as dem say e be like two of dem no get relatives for Australia.

But di family of Ashlee Good – mama of di injured baby - say she dey among di pipo wey dem kill.

Witnesses tell local tori pipo say madam Good desperately carry her pikin give pipo wey dey dia immediately afta she injure.

Ashlee Good

Wia dis foto come from, Handout

Wetin we call dis foto, Ashlee Good na 38-year-old mother - her baby still dey for hospital

"Dem stab di mama and di mama come over wit di baby, throw am to me and I bin dey hold di pikin," one man tell Nine News.

Di nine-month-old girl "bin do operation overnight and currently dey critical condition and she dey ICU," Health Minister Ryan Park tell ABC news.

"Now, we dey hope say she go fit come out of dis but she get a long way to go."

Madam Good family eye still dey "turn from di terrible loss of Ashlee, one beautiful mother, daughter, sister, partner, friend, all-round outstanding human and so much more".

"We appreciate di well-wishes and thoughts of members of Australian public wey show love for Ashlee and our baby girl," di family tok for one statement on Sunday.

Another victim na Faraz Tahir, one 30-year-old man from Pakistan wey come Australia for refuge one year ago, according to Ahmadiyya Muslim Community of Australia.

Tahir na security guard and "cherished member" of di local community wey dem sabi for im "unwavering dedication to kindness", one statement tok.

Dawn Singleton, 25, also die, her employer White Fox Boutique tok. "We dey truly devastated by dis loss. Dawn bin be sweet, kind-hearted person wey bin get her whole life ahead of her. She bin dey really amazing," di company write online.

Prime Minister Anthony Albanese say Australia ppipo dey "wake up to try to deal wit di shock and trauma" of wetin bin happun.

Describing di attack as "unspeakable and really just beyond comprehension", Albanese again praise di actions of one lone senior policewoman wey confront Cauchi and shoot am dead as fear catch pipo for di mall.

"Di wonderful inspector wey run into danger by herself plus remove di threat wey bin dey face odas, witout tinkin about di risks to herself, "di prime minister tok as im tank her and di emergency teams.

Police identify her on Sunday as Inspector Amy Scott, kon add say she no get any plan for now to speak for public about wetin happun.

How e bin happun

Sydney stabbing

Wia dis foto come from, Getty Images

Police bin declare critical incident afta shooting of one man just before 16:00 local time (07:00BST; 08:00GMT) on Saturday 13 April afta dem get reports of stabbings.

Dem bin urge pipo to avoid di area.

Video footage show many police and ambulance dem for di scene, and images for social media appear to show multiple casualties, as well as one man wey dey carry large knife.

One eyewitness tell Reuters news agency say dem see pesin wey lie down down injured and dem look wetin dey go on.

"Den we saw all dis pipo wey dey run towards us and den we hear one shot and my husband drag us into di Adairs shop and den we get di lady dia trying to lock di doors and den she no fit lock di front door so we enta di office wey dey all locked and den we dey inside until di police come get us."

Sydney stabbing

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Paramedics wit stretchers outside di Westfield Bondi Junction shopping mall afta a stabbing incident for Sydney on April 13, 2024.

Eyewitnesses tok wetin dem see

Eyewitnesses bin describe di kasala as horror as dem run comot from di busy Sydney shopping mall.

"Na madness," one woman wey dey para well well tok, as she describe how she see one woman wey wound lie down for floor.

Dem see crowds of pipo dey run comot from Westfield shopping centre for Bondi for di east of di city as dozens of emergency vehicles dey respond to di incident.

One Officer shoot di attacker dead, police tok.

Anoda eyewitness say im hear "pipo dey shout and scream as dem dey run".

Im say im follow one policewoman bifor im see one man wey dey come towards dem wit one "big blade".

"Im just start to waka towards us and all wetin I bin hear na 'put am down' and den she shoot am. If to say she no shoot am im for continue to waka, im bin dey on rampage."

Im tok say di man look like pesin wey dey "on a killing spree" and say im see two deadi bodi of one man and one woman near one wedding shop.

Police pipo for di scene of Sydney shooting

Wia dis foto come from, APTN

Wetin we call dis foto, Police pipo for di scene of di shooting
Graphics wey show di location wia di shooting happun

Wia dis foto come from, BBC /Google

Wetin we call dis foto, Graphics wey show di location wia di shooting happun

Anoda eyewitness tell Reuters news agency say im bin see pesin wey lie down wit wound and and im bin dey look to see wetin dey happun.

"Small time we see all dis pipo dey run run towards us and den we hear one shot and my husband dragged us inside di Adairs shop and den we got tell di lady for dia to lock di doors. She bin no fit lock di front doors so we enta di office and we lock oursefs inside dia until police come carry us."

Australia prime minister say dem don brief am about di incident.

"Tragically, dem don report multiple casualties, di first tin wey dey all Australians mind na "which pipo dey affected and dia loved ones," im write for X.

"Our hearts go out to di pipo wey wound and we offer our tanks to di pipo wey dey care for dem as well as our brave police and first responders."

Westfield mall na major shopping centre for di east of Sydney central business district and close to di famous Bondi Beach.

PM praise 'hero' female officer wey shoot di suspect dead

 Anthony Albanese
Wetin we call dis foto, Anthony Albanese praise police officer wey shoot di attacker dead

For one press conference, Australian Prime Minister Anthony Albanese, express im condolences to di victims of di attack.

E tok say police don confirm say na six pipo di man fatally stab while several pipo dey receive treatment for hospital sake of dia injuries.

"Wetin we fit say for sure tonight be dis: To any Australian wey dey affected by dis tragedy, evri Australian dey wit you," di prime minister tok.

Albanese also single out di police officer wey shoot di attacker dead.

"I speak bifor about di bravery wey don dey exhibited here, di bravery of di police officer ... she enta di proceedings wey bin dey take place, obviously veri dangerous by herself," di prime minister tok.

"She certainly be hero. No doubt say she save lives through her action."

Witnesses for di scene don dey describe how di officer run towards di man, and tell am to put down im knife, bifor im shoot am once for chest.

Di officer bin attempt to perform CPR on di attacker, wey later die, authorities tok.