Tembisa hospital shooting: South Africa police confam dia officer allegedly kill im 30 year-old partner wey be nurse for her work place

Wia dis foto come from, others
South Africa police confam say one of dia officer dey involved for one deadly shooting wey happun for Tembisa hospital for Guateng
Dem tok say di officer shoot and kill im 30 year old partner, Lebogang Monene wey be nurse for her work place on on Wednesday morning.
According to di statement, di officer, bin drive enta di facility inside official vehicle, then turn di gun on imself and im dey critical condition.
Di incident leave patients and staff in shock, di Gauteng Department of Health tok for inside statement.
Guateng health authorities bin first close down di hospital afta di incident but later reopen am to public.

Wia dis foto come from, Guateng Province
How di incident happun
Tembisa Hospital say na around 08:00 on Wednesday , di 30 year old police officer enta di hospital driving a state motor wit blue lights on.
E park for di Accident and Emergency Department parking lot.
Di man later call im 30 year old partner wey dey on duty at dat time to come di parking lot.
End of Di one wey oda users dey read well well
"As she arrive di place, di officer open fire on fi enrolled Nursing assistant and turn di gun on imsef", di hospital tok.
Unfortunately, di nurse die on di scene of di accident while di police officer currently dey critical condition.
Dr Nomathemba Mokgheti wey be Guateng health commissioner describe di incident as unfortunate and say e dey sad.
Wen she visit di family home of Lebogang Monene, she follow tori pipo tok say di commission togeda wit management of labour unions go review and implement security measures wey go enhance di protection of staff and patients.

Wia dis foto come from, Dr Nomathemba Mokgethi
Wetin police tok
SAPS spokesperson Brigadier Brenda Muridili wey visit di hospital say di officer dey in acritical condition for di Milpark hospital wia im dey receive medical attention.
Sake of dis, Tembisa hospital say dem close down temporarily to allow police do dia work.
Police say dem don launch investigate wey go reveal di motive behind di incident.
Di investigation go also let us know di history of domestic violence between im and di partner.
Dis no be di first time wey cases of gender based violence against women go come up for South Africa
South African President Cyril Ramaphosa bin don tok say dem need urgent action to tackle gender-based violence for di kontri.
E tok am for one emergency sitting of parliament wey hold for 2019 , Oga Ramaphosa say di figures for violence against women and children dey similar to those of a kontri wey dey at war.
Report show say dem men kill about 2,700 women and 1,000 children for 2018 and at least 100 cases of rapes bin dey reported every day.
Di increase in violence against women don cause plenty protest across di kontri.












