'Bello Turji na dead man walking' - Nigerian military tok as dem list terrorist leaders dem eliminate for 2024

Bello Turji amongst his men

Wia dis foto come from, Sheik Gumi

Read am in 3 mins

Di Nigerian military don described di notorious bandit and terrorist leader, Bello Turji, as a "dead man walking."

Na di Director of Defence Media Operations, Edward Buba, yarn dis for Abuja on Tuesday 31 December as im brief journalists on di operations of di military in 2024.

Turji na notorious terrorist and bandit leader wey dey operate for North-western Nigeria, particularly Zamfara, Sokoto and Niger states.

Buba say e dey important to realise say terrorists exist for di sake of war and gatz dey destroyed for di sake of peace.

E say di troops don sustain pressure on di terrorist enclaves, hideouts, and strongholds as incentive to speedily defeat di terrorists and hastily end di war.

"During di course of di year, troops eliminate thousands of terrorists and also dia commanders and combatants among odas."

Buba say similar fate await dose wey dey parade demsef as terror leaders and commanders today.

"Take am from me, im (Turji) na merely dead man walking, as e go soon follow suit wit many odas wey don dey eliminated during di course of di year.

"To refresh your memory, I go read out some of di names of notable terrorist leaders wey we don take out since January dis year," Buba tok.

Terrorists wey military eliminate

Halilu Sububu

Dutse Mainasara Idda

Mallam Saleh Umaru

Mohammed Amadu

Abubakar Musa

Adamu Tanko Ibrahim

Yellow Dogon Rakumi

Isiya Boderi

Alhaji Baldu.

Usman Modi Modi

Kachalla Halilu

Kachalla Tukur

Amir Ibrahim Bukar

Saidu Hassan Yellow

Buba Kachalla Bukar

Bakura Jega

Abba Tukur

Buba say di military no go hesitate to defend Nigeria from terror attacks wit overwhelming military force to continue to deliver ogbonge benefits for all Nigerians.

E say several terrorist leaders, combatants and dia families also surrender as a result of di intensity of troops operations.

Bello Turji profile

Dem born Bello Turji for Shinkafi local goment area of Zamfara State, northwest Nigeria.

But di time wey dem born am, Zamfara and Sokoto be one state so e no too clear weda na for di Sokoto part dem start to dey live.

"Na for Shinkafi dem born am, na from since e small im father dey carry am go animal market just like any young Fulani boy." Dr Murtala Ahmad Rufai tok.

Dr Rufai na na lecturer for history department of Danfodio University and author of di book 'I Am a Bandit'.

Di lecturer add say Bello age go dey between 27-35 years as at 2022 wen e (Rufai) tok to BBC Hausa.

"Im father Usman na good man wey dey live in peace wit evribodi for Shinkafi area."