How US capture Venezuela President Nicolas Maduro and why

Picture of Maduro on board di USS Iwo Jima after im arrest

Wia dis foto come from, Donald Trump

Wetin we call dis foto, Trump post picture of Maduro on board di USS Iwo Jima after im arrest
Read am in 8 mins

US don capture Venezuela President Nicolás Maduro after one large-scale strike on di South American country, US President Donald Trump don tok.

Trump say dem fly out Venezuela left-wing president and im wife in one military operation out in conjunction wit US law enforcement. Dem don charge am with drug and weapons offences for New York.

E come after reports of explosions across di capital Caracas for di early hours of Saturday morning, including for military bases.

Venezuelan govment bin deploy im armed forces and declare a national emergency.

Maduro capture come after big tension between di two countries, with Washington wey strike boats for di Caribbean wey e say dem dey use to carry drugs.

US bin don accuse di Venezuelan president of being personally involved in drug-smuggling and say e be illegal leader, while Maduro don accuse US of intimidation and wanting to seize dia oil.

Trump during one news conference on Saturday say US go "run" Venezuela "until a safe and proper and judicious transition", adding say American oil companies go also move into di country.

One eye witness for di kontri capital Caracas say "My heart bin dey pump and my legs bin dey shake," - video show big smoke as fire dey burn.

Dis dey come afta weeks of serious tension as Trump dey put pressure on Maduro, wey im dey accuse say e "empty im prisons and insane asylums" and say e dey "force" inmates to migrate to di US.

How US capture Maduro

Na di US army Delta Force - di military top counter terrorism unit capture Maduro, BBC US news partner CBS News report.

One CIA source inside Venezuelan govment help US track Maduro location - part of one extensive intelligence network, CBS tok.

Speaking togeda with Trump on Saturday, Gen Dan Caine, chairman of di US Joint Chiefs of Staff, say Operation Absolute Resolve take months of planning and rehearsals, with forces waiting for di right weather.

More dan 150 aircraft na im dem use to get di extraction team inside di capital.

Di team come in and enter Maduro compound - "house wey dey like fortress", according to Trump - at 02:01 local time (06:01 GMT) - with di lights for Caracas wey America bin don turn off.

Di US president say Maduro bin try to enter one steel-fortified safe place, e reach di door, but e no fit close am.

E add say no US forces die and and na "few" injuries dem record for di operation, wey e say e bin watch live.

Dem put Maduro and im wife ontop ship and send dem on dia way to New York.

Fire catch di military base as e dey in flames.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Fuerte Tiuna, one of Venezuela largest military base wey di bomb hit

Wetin be di charges against Maduro?

US Attorney General Pam Bondi say dem sama charges on Maduro and im wife wey dey indicted for di Southern District of New York.

Dem charge Maduro wit "Narco-Terrorism Conspiracy, Cocaine Importation Conspiracy, Possession of Machineguns and Destructive Devices, Conspiracy to Possess Machineguns and Destructive Devices against di United States".

She add say, "dem go soon face di full wrath of American justice on American soil for American courts," Bondi tok. But she no tok wetin dem charge im wife wit.

"A huge thank you to our brave military wey conduct di incredible and highly successful mission to capture dis two alleged international narco traffickers," she add.

President of Venezuela, Nicolas Manduro and im wife pose for foto

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Maduro dey indicted for New York sake of drugs and weapons charges

How Venezuela don respond?

Helicopters flying above Caracas sake of di bomb

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Helicopters wey dey fly above Caracas di capital of Venezuela sake of di bomb

Venezuela wey don announce a state of national emergency, reject and condemn "military aggression".

Venezuela Vice President Delcy Rodríguez say di govment no know di whereabouts of President Maduro or di First Lady Cilia Flores.

She add say di govment demand "immediate proof of life" for both of dem.

Venezuela Defence Minister also announce immediate deployment of military forces across di kontri.

Speaking in Spanish inside one video address, Vladimir Padrino López call for a united front of resistance in di face of "di worst aggression" ever against Venezuela, adding say Venezuela dey follow "Maduro's orders" dat all armed forces go dey deployed.

"Dem don attack us but dem no go subdue us," di defence minister tok.

Foto wey show as flame dey go up from high rise building

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Foto wey show as flame dey go up from high rise building

Why US capture Maduro and attack Venezuela?

Dis na di biggest US military build-up for America since di Cold War – e big well-well.

US for long don accuse Nicolás Maduro of leading an international drug trafficking organisation, something wey Maduro don deny.

US bin offer a $50m reward for information leading to di arrest of Maduro.

Dat, along wit di big military build-up for di region over di last few months, bin dey interpreted for di region as encouragement for someone inside di kontri to turn against am.

How di mata take reach here today?

  • First, dem bomb speed boats wey dey allegedly carry drugs through Venezuelan waters.
  • E don extend into di eastern Caribbean, Pacific and oda places. Na 110 pipo don die so far.
  • US forces don seize two oil tankers, and dem dey pursue di third one.
  • During Christmas, Trump bin make reference to di first land strike.

We no too get details about am, even though BBC dey chook eye inside di statements wey witnesses make.

E dey believed say na for Zulia wey be oil-rich state e hapun.

On 29 December, President Trump bin tok say US forces bin carry out strike on di docking area for alleged Venezuela drug boats without specifying di location of di attack.

Trump dey blame Maduro for di arrival of hundreds of thousands of Venezuelan migrants wey enta US.

Dem dey among di close to eight million Venezuelans wey dem estimate say dem run enta US sake of economic crisis and repression for di kontri since 2013.

Trump dey also focus on fighting di kain drugs wey dey enta di US from Venezuela - especially fentanyl and cocaine.

Im don name two Venezuelan criminal groups - Tren de Aragua and Cartel de los Soles - as Foreign Terrorist Organisations (FTOs) as im bin allege say na Maduro dey lead one of di groups..

But Analysts don point out say Cartel de los Soles no be hierarchical group but na term wey dem dey use describe corrupt officials wey dey allow cocaine to pass through Venezuela.

Trump bin don also double di reward for information wey fit leading to Maduro capture and im bin announce say im go name Maduro govment as FTO.

Maduro bin don seriously deny say im dey lead any cartel and im bin accuse di US of using di "war on drugs" as excuse to try to remove am so dat US fit collect Venezuela big oil reserves.

Dis kain tin don hapun before and wetin next?

According to BBC World affairs correspondent Joe Inwood, if na true say US send Delta Force inside di heart of di Venezuelan capital and extract di sitting president, togeda wit im wife, e no be like anything wey we don see before.

Di closest go be di capture of Panamanian leader Manuel Noriega, also by special forces, for 1989.

Both men bin don recently claim victory inside controversial elections, both bin dey accused by di US of involvement in drug trafficking and both bin see significant US military build-up.

But Noriega capture na after one short, decisive, war between di two kontris, wia dem quickly deal wit Panamanian forces.

E bin take refuge for Vatican embassy, wia e remain for 11 days.

Eventually, dem persuade Noriega to leave after dem use "psychological warfare" - specifically di constant playing of loud rock music, including The Clash, Van Halen and U2.

Dem take am back to US, wia dem convict am of drugs offences.

Details of di operation to capture Nicholas Maduro never yet come out, but e be like operation wey even dey more ambitious in terms of di scope - succeeding in extracting di president and im wife without di use of ground forces.

Im fate never clear yet, but one fit imagine say e go end inside US prison.

Profile of Nicolas Maduro

Nicolás Maduro na di President of Venezuela wey rise to prominence under di leadership of left-wing President Hugo Chávez and im United Socialist Party of Venezuela (PSUV).

Maduro, na former bus driver and union leader, wey succeed Chávez and im don be president since 2013.

During di 26 years wey Chávez and Maduro bin dey for power, dia party gain control of key institutions including di National Assembly, much of di judiciary, and di electoral council.

For 2024, dem bin declare Maduro winner of di presidential election, even though voting tallies wey di opposition parties collect suggest say candidate, Edmundo González, bin win wit veri high margin.

Dem bin give her di Nobel Peace Prize for October for "her struggle to achieve a just and peaceful transition from dictatorship to democracy".

Machado no send about di travel ban as she find way enta Oslo in December to collect di award afta months of hiding.

She bin tok say she plan to return to Venezuela, a move wey fit put her at risk of arrest by di Venezuelan authorities, wey bin declare her a "fugitive".