Police identify and charge woman wey fire gunshots at Rihanna house wit attempted murder

Rihanna has short hair wearing a black furry coat

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Jake Lapham
  • Read am in 3 mins

Police for Los Angeles don arrest one 35-year-old woman on suspicion of attempted murder afta gunfire touch di home of pop star Rihanna.

Dem dey hold Ivanna Lisette Ortiz for custody and di bail dey set at $10.2m (£7.6m).

Officers bin respond to reports of gunfire for di Beverly Hills mansion at 13:15 local time (21:15 GMT) on Sunday.

Armed wit one AR-15-style weapon, di attacker allegedly shoot from one vehicle wey dey move towards di singer house, di Los Angeles Times report.

Rihanna bin dey inside di mansion at di time, one law enforcement source tell di newspaper, but nobodi injure. Di motive neva dey clear.

Police officer tell BBC US Partner, CBS News say di house wey dem bin target na Rihanna own and say dem find assault rifle casings for di scene.

A police vehicle is parked on a road with an officer standing next to it

Wia dis foto come from, Getty Images/DUTCH/Bauer-Griffin/Contributor

Wetin we call dis foto, Police bin dey stationed outside Rihanna domot on Sunday

Di suspect white Tesla bin dey located about eight miles (12km) from di singer house for Sherman Oaks Galleria shopping centre, na dia authorities bin take her into custody.

Di alleged attacker na from Orlando, Florida, according to one Fox News station for Tampa.

Na last year September Rihanna bin born her third pikin, wey be girl to her partner, A$AP Rocky.

Di couple wey already get two boys togeda, Riot and RZA bin announce di news of Rihanna latest belle for last year Met Gala.

But also for February 2025, dem find A$AP Rocky guilt for firing of gun on im former friend. Rihanna bin show for dis trial for court togeda wit her first two children.

Di Barbados-born celebrity, wey her full name na Robyn Rihanna Fenty, bin rise to prominence for di early 2000s wit hits like Pon de Replay and Umbrella.

Di nine-time Grammy winner recently celebrate 20 years since di release of her first album.

During dat time, Rihanna don launch multiple businesses, including her popular makeup range Fenty Beauty plus one lingerie company.

Di 37-year-old networth dey estimated by Forbes at ova one billion dollars.

BBC don contact Rihanna representatives for comment.

Dem born Rihanna for Barbados and di name wey her pipo give am na Robyn Fenty.