'Na my first time inside bunker' - Ghanaian man tok wetin im eye see for Israel
'Na my first time inside bunker' - Ghanaian man tok wetin im eye see for Israel
One Ghanaian man wey dey live for Tel Aviv suburb for Israel don describe di traumatising experience im get wen Hamas attack Israel wit airstrike.
Seth Cudjoe tell BBC News say im and im wife and newborn pikin gatz enta bunker, and add say na di first time wey im go enta bunker be dat.
Cudjoe tok say na school im go school for Israel and im decide to marry and get im own family for di Middle Eastern kontri.
Palestinian militant group Hamas on 7 October launch dia biggest attack in many years on Israel.
Militants bin cross to Israel from Gaza under cover of heavy rocket fire - and dem don take dozens of Israelis as captive.







