Who dey contest wit former Vice president Bawumia for di opposition flagbearer election for Ghana

Wia dis foto come from, NPP ASPIRANTS/FACEBOOK
Ghana biggest opposition party di New Patriotic Party (NPP) go vote on 31 January to elect dia flagbearer for di 2028 general elections.
Di party dey elect dia candidate early – so dem go get more time to market and campaign ahead of di next presidential election for 2028.
Five pipo including di former vice president Dr Mahamudu Bawumia dey contest for di position.
Ova 200,000 delegates of di party across di 16 regions of di kontri go vote for 333 polling stations for di 276 constituencies.
Di voting go start at 7 AM (GMT) and close at 2 PM (GMT).
Oga for di party presidential election committee, Joseph Osei-Owusu say "everitin make set for di vote."
"At every stage we involve di candidates – we show dem di voters list, we also listen to dia complaints wey we solve dem."
Joseph Osei-Owusu add say "di electoral commission make ready, di police and everybody else make ready for di 31 January vote."
Bifor di election, di party make di five candidates sign wetin dem call "peace pact" say dem go accept di outcome of di election wey di losers go support di candidate wey go win.

Wia dis foto come from, HENRY NANA BOAKYE/FACEBOOK
Di five candidates all say dem go win di vote
Dr Mahamudu Bawumia – Di former vice president be economist wey he lead di NPP for di 2024 election wia di party lose by more than one million votes.
Bifor he enta active politics, Dr Bawumia be deputy governor of di bank of Ghana between 2006 – 2008. For 2011, he be di resident representative of di Africa development bank for Zimbabwe.
Di 62-year-old contest as running mate for di NPP wit Nana Akufo-Addo for di 2008 elections. For di 2012 election, candidate Nana Akufo-Addo re-elect am as running mate – dem eventually lose di general elections.
As running mate for 2016, di NPP win elections wey Nana Akufo-Addo become president, Dr Bawumia become vice. Dem rule di kontri for eight years bifor dem lose di 2024 elections to di NDC candidate, John Mahama.
Kennedy Ohene Agyapong – E be businessman wey serve as parliamentarian (member of parliament) for Assin Central constituency for di Central region for 24 years from 2000 to 2024.
E neva lose parliamentary election until when he decide say he no go seek re-election in 2024 sake of he get presidential ambition.
Kennedy Agyapong wey get civil engineering degree, travel to di US wia he begin business; he later get investments for dia bifor he return to Ghana.
E get many businesses - e get radio stations, TV channels, real estate business wey e also get farms.
Di 65-year-old also get steel company for di kontri. Many pipo describe am as pesin wey dey speak his mind; some pipo say he be controversial.
He decide say he go contest for primaries of di NPP to get chance to stand for president.
Dr Bryan Acheampong – he be entrepreneur and politician wey currently dey serve as member of parliament for Abetifi constituency for di Eastern region; he be MP for eight years.
Di 53-year-old serve as minister for Agriculture and minister for interior under di previous govment.
He also serve as minister for national security at some point for di last administration.
For business, Dr Bryan Acheampong dey own hotels, software development company and media and communication company.
Dr Acheampong get PhD for information systems from di University of Ghana wey he also be PhD candidate for security and intelligence for di University of Buckingham.
Dr Yaw Osei Adutwum – di 61-year-old educationist dey contest di flagbearership slot of di party afta he serve as education minister under di previous govment. He get PhD for education policy and administration from South California.
Currently, Dr Adutwum be member of parliament for di Bosomtwe constituency for di Ashanti region of Ghana.
Dr Adutwum teach maths and information technology for one high school for Los Angeles.
He later become owner of three schools for di US wey he get investments for Ghana.
Kwabena Agyei Agyepong – di 63-year-old be civil engineer and politician. He be former sports commentator and presenter wey cover di world cup for Seoul 1998, Barcelona 1992 and di 1996 Atlanta Olympic games for di state broadcaster – GBC.
For 2001, Kwabena Agyepong serve as press secretary to di president at di time, John Agyekum Kufour wey he be spokesperson for di president until May 2006.
He serve as general secretary of di NPP afta he win election in 2014 bifor dem suspend am in 2015 togeda wit about 45 oda party members.
Dem chop accuse say dem "publicly rebel against di party decision" to suspend di chairman, Paul Afoko.
Kwabena Agyepong describe his suspension at di two-year suspension as "unconstitutional".
Dem lift di suspension for 2021wey pave way for hi to return to contribute to di party.
All five candidates say dem sell dia message to di delegates, wia dem go win.
Whoever go win di 31 January vote go be di presidential candidate for di NPP wey go face di govment party candidate for di 202 elections.









