Wetin we know about gunfire and loud blast for Niger capital Niamey

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO/AFP via Getty Images
Pipo hear sustained heavy gunfire and loud explosions for Niger near di international airport outside di capital, Niamey.
Multiple eyewitness accounts and videos show as di air defence systems dey clearly engage unidentified projectiles for di early hours of Thursday, 29 January.
Di situation later calm down, reports tok. One official reportedly tok say di situation now dey under control, wit no further details.
E neva dey clear wetin cause di blasts, or if anybodi kpai. No official statement from di military govment yet.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Di gunfire and blasts start shortly afta midnight, according to residents of one neighbourhood near di Diori Hamani International Airport, di AFP news agency report. Dem say calm return afta two hours.
Di airport dey house one air force base and e dey located about 10km (six miles) from di presidential palace.
Like dia neighbours Burkina Faso and Mali, Niger military govment don dey fight jihadist groups wey don carry out deadly attacks across di region.
Di kontri also na major producer of uranium.
During di gunfire, dem attack one huge uranium shipment destined for export for di airport for di middle of unresolved legal and diplomatic complications wit France afta di military govment nationalise di uranium mines.
"Di situation dey under control. No need to worry," di Anadolu news agency quote one Foreign Affairs ministry official, witout more details.
Di official tell di agency say dem dey try to determine weda di gunfire get any connection to di uranium shipment.
Abdourahamane Tchiani na di leader of Niger. E seize power for one 2023 coup wey comot di kontri elected civilian president Mohamed Bazoum.
For Wednesday, 26 March 2025, dem swear General Tchiani n as di kontri president for a transitional period of five years.
General Tchiani take di presidential office under one new charter wey replace di West African kontri constitution.
Dem also promote am to di kontri highest military rank of army general, and e sign one decree wey order di dissolvement of all political parties.
During one ceremony for di capital, Niamey, Gen Tchiani tok of im new military rank: "I receive dis distinction wit great humility... I go try to live up to di trust kontri pipo place in me."









