Wetin be di latest about Bollywood actor Dharmendra death rumour

Wia dis foto come from, Raj K Raj/Hindustan Times via Getty Images
Plenti tori don dey surround di health status of ogbonge Bollywood actor and producer Dharmendra Deol.
Di tori don touch plenti pipo for India, afta different local media platforms dey report say di ogbonge actor don die.
But Dharmendra family don debunk di tori about di death rumour of Dharmendra say na lie.
Dharmendra wey be 89 years old and go turn 90 years by December 2025 don dey reported bifor say e dey hospitalised.
Meanwhile, Dharmendra wife Hema Malini write for her social media page say her husband dey stable, make pipo give dem di privacy wey dem need at dis period.
Dharmendra na big name for India movie industry, especially wit im role for plenti Bollywood movies wey pipo watch wen dem dey grow.
Na im dey also dey call 'Dharam ji' for di India movie industry, but Dharmendra health dey give pipo concern.
Esha Deol wey be daughter to di legendary Dharmendra say her papa dey recova and e dey stable.
For her post for Instagram, she say make media pipo stop to dey spread false news, about her papa health status.
'Give our family privacy'- Dharmendra daughter
"Be like say di media dey for overdrive and spreading false news. My papa dey stable and dey recover."
Esha Deol say di family dey "request evrione make dem give our family privacy' and Dharmendra dey recova.
Earlier, Esha Deol, bin post picture of her wen she dey small and her papa Dharmendra and mama dey by her side.
On di oda hand, di Dharmendra wife Hema Malini also kwesion why some media platforms dey spread false news about her husband.
She say di Bollywood actor wey also be her husband dey respond to treatment and e dey 'disrespectful' to dey share false news about am.
"Wetin dey happun dey unforgivable! How responsible channels dey spread false news about pesin wey dey respond to treatment and dey recova?"
"Dis dey extremely disrespectful and irresponsible. Abeg give due respect to di family and dia need for privacy," Hema Malini write for X.
Hema Malini Dharmendra Deol na also Indian actress, director and producer for Bollywood.
Earlier bifor dis whole tok tok for social media about, Hema Malini don tok about Dharmendra health wen dem carry go hospital.
She say her husband bin dey hospital 'for observation' and dem dey 'continuously monitored am.
Sake of di false news wey some news platforms for India don report about Dharmendra, some oda actor bin dey send condolence messages but dem later delete am wen dem hear say di ogbonge actor still dey.

Wia dis foto come from, STR/AFP via Getty Images
Dharmendra na actor and movie producer for India. E dey widely known as one of di greatest and successful feem stars for di history of Indian feem industry.
For 2012, dem honour am wit di Padma Bhushan, wey India third highest civilian honour. Dis na sake of im contribution to di Indiam feem industry.
Dharmendra collect di 'Living Legend Award" by di Federation of Indian Chamber of Commerce and Industry (FICCI) as part of recognition for im correct contribution to entertainment for India.
E kollect di 'Lifetime Achievement Award' by di state of New Jersey for United States for 2020, as part of honour for im works.
Dharmendra don do plenti feems for plenti years and e go be 90 years old by December 2025.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post









