Duduzile Zuma-Sambudla: South Africa ex-president daughter plead not guilty to terrorism charges

Wia dis foto come from, Supplied
Di terrorism trial of Duduzile Zuma-Sambudla wey be di daughter of former South Africa President Jacob Zuma don start for di High Court for Durban on Monday, 9 November.
She plead not guilty and her lawyer tok say di case wey di state get against her dey weak.
43-year-old Duduzile Zuma-Sambudla dey face trial on top accuse say she use social media to incite violence and terrorism through her social media posts during di July 2021 deadly protests wey lead to di death of 350 pipo.
Prosecutors allege say Duduzile Zuma-Sambudla bin incite odas to commit acts of violence for posts she write on social media for July 2021 wen civil unrest break out afta authorities arrest her father, former President Jacob Zuma on top accuse say e disobey court order to testify for one corruption inquiry.
For one of her posts, she bin include one Zulu word "azishe" wey literally mean "let it burn" but for slang e fit mean "Make di kasala start".
She don repeatedly tok say di charges against her na attempt to settle political scores wit her father, afta e start im own political party and campaign against di African National Congress.
Zuma-Sambudla dey face three counts wey relate to her online posts during di civil unrest.
Count one wey be di incitement to commit terrorism. Prosecutors allege say between June 29 and July 2021, Zuma-Sambudla unlawfully and intentionally incite odas to commit acts of terrorism.
Count two na di incitement to commit violence. Di state claim say she instigate or encourage pipo to gada unlawfully wit di intent to disturb public peace or infringe on odas rights.
Count three na di Violation of di Riotous Assemblies Act. Di third charge relate to a violation of Section 17 of di Riotous Assemblies Act 17 of 1956, wey prohibit illegal gatherings intended to cause a riot.
Jacob Zuma nine-year presidency, wey controversies full bin come to an end for 2018 for di middle of corruption allegations – e deny all di accuse.
Den for 2021, dem jail am sake of say e fail to show up for one corruption inquiry. Dis mata cause protests plus di worst scenes of violence since di beginning of di democratic era for 1994.
One week of katakata for KwaZulu-Natal and Gauteng provinces, wey include looting and arson, bin leave at least 300 people dead and e cause a$2.8bn (£2.2bout bn) damage.
Prosecutors allege say Zuma-Sambudla play ogbonge role in adding fire to di violence.
Few supporters from her party, uMkhonto weSizwe, show for KwaZulu-Natal high court, including her father plus oda party leaders.
In recent years, Zuma-Sambudla bin emerge as di former president most strongest supporter as she dey always dey im side. She don also become member of MK parliament.
For 2021, she para wen dem arrest her father and she post fotos from di looting. Di allegation na say dis bin escalate wetin dey hapun and ginger her plenty social media followers, like 100,000 at di time, to carry out destruction.
Zuma-Sambudla dey accused of incitement to commit terrorism under di Protection of Constitutional Democracy against Terrorist and Related Activities Act. She also dey accused of di incitement to commit public violence.
Several posts from July 2021 ontop wetin dey known before as Twitter dey di heart of di state case against her.
For one tweet, she bin share post wey call for di "shut down" of KwaZulu-Natal including "roads, factories, shops [and] govment" until dem release di former president.
Who be Duduzile Zuma-Sambudla?
Dem born and raise di MP for Mozambique, wen her father bin dey live on exile afta e spend 10 years as political prisoner for South Africa.
She grow up wit her twin brother Duduzane and she be one of Zuma five children wit im third wife Kate Mantsho – wey take her own life for 2000.
Duduzile and Duduzane na one of Zuma rumoured 20 children wit several wives and former partners wey dey very popular.
For several years, na Duduzane dominate di headlines afta im association wit di controversial Gupta family bin come to light for di early 2010s.
Dat family bin dey di centre of di corruption allegations wey affect Zuma presidency.
Di Guptas and Zuma don deny any wrongdoing.
Apart from her ogbonge wedding to businessman Lonwabo Sambudla for 2011, wey dem call di wedding of di year at di time, Zuma-Sambudla bin no dey spotlight.
She mostly focus on raising her two daughters and being a housewife, according to South Africa Daily Maverick news site.
She separate from her husband for 2017.










