Shah Rukh Khan enta billionaire club - How di Indian actor dey make im moni

Shah Rukh Khan at the 2025 Met Gala, wearing sun glasses and several neck pieces. The gala was held at the Metropolitan Museum of Art on May 05, 2025 in New York city.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Shah Rukh Khanna one of di biggest stars for Bollywood
    • Author, Cherylann Mollan
    • Role, BBC News, Mumbai
  • Read am in 3 mins

Bollywood superstar Shah Rukh Khan don join di billionaire club for di first time. According to new list, e don becom one of di richest actors for di world.

Di 59 year old net worth dey estimated to reach $1.4bn according to di Hurun India Rich List 2025 wey dey yearly rank of India wealthiest pipo.

Oda Bollywood celebs wey di list include na actress Juhi Chawla, actors Hrithik Roshan and Amitabh Bachchan and film director Karan Johar.

How Shah Rukh Khan take make im moni

Shah Rukh Khan dey popularly known as Bollywood king of romance, and don spend ova thirty years for di Hindi feem industry but now e don rearrange imsef from actor to running big production house and own cricket team.

Anas Rahman Junaid, wey be founder and chief researcher for Harun India tell di BBC say, "Khan billionaire status na mostly from di stakes from Red Chillies Entertainment (im production company) and Knight Rider Sports (im IPL cricket club)".

Di oda ways e dey take make moni na from feem, advertisements as well as investments for real estate across di world.

Oga Junaid tok say as Khan dey enta di billionaire list na reflection of di changing nature of di way India economy dey grow.

E mean say di way pipo dey make moni don move from traditional sectors like manufacturing, IT and banking.

Now na sports, entertainment and IP-driven businesses moni dey for India, according to am.

According to oga Junaid, e be like wetin happun for US wia di rich lists wey bin dey full of business pipo and bankers now get sport team owners, media moguls and celeb-led brands like Michael Jordan, LeBron James, Oprah Winfrey and Beyoncé.

But Forbes say even though many celebs don get moni well-well, "e dey rare to see dia moni to enta ten figures", wit less dan two dozen pipo for di planet wey don reach dat amount.

Even though four oda Bollywood stars and dia families don enta Hurun list dis year, Khan wealth dey estimated to dey higher by far.

Juhi Chawla, wey don act wit Khan for plenti feems and her family dey number two wit net worth of $880m.

Di list also get Hrithik Roshan for number three wit $260m, and den director Karan Johar wit about $200m and actor Amitabh Bachchan and im family wit $183m.

For 2024, Johar bin make headlines wen e sell 50% stake for im production company Dharma Productions to billionaire Adar Poonawalla, wey be India top vaccine maker for $119m.

India overall billionaire don pass 350 pipo dis year, and billionaires Mukesh Ambani and Gautam Adani dey retain top two spots according to Hurun India.