'I no well, I dey undergo mental health treatment for psychiatric hospital' - wanted singer Portable tok

Habeeb Okikiola

Wia dis foto come from, Portable/Instagram

Read am in 4 mins

Popular Nigerian singer Habeeb Okikiola, wey pipo sabi as Portable, don tok say im get mental problem.

E say im dey undergo treatment for Federal Neuropsychiatric Hospital, Aro, Abeokuta.

Di popular singer for one video wey e post for im social media page dey beg Nigerians and govment of Ogun state say make dem help am.

Di video dey come afta police declare Portable wanted on Monday night sake of allege assault on govment officials.

For di video, Portable wey bin tok plenti tins also allege say di whole gbege na set up by some pipo wey wan turn am against di govment.

Portable further tok say e be madman and get card for Aro hospital wia e dey go collect treatment.

"I fear govment. I be federal govment liability. Den I be madman; I get medications wey I usually take. You fit confam from Aro Hospital. I get card wey certify me as one of dia patients, di singer tok.

Earlier, Police declare Nigerian singer Habeeb Okikiola, wey many pipo sabi as Portable wanted.

Di declaration dey one police gazette wey di Ogun State Command of di Force publish on Monday night.

"Portable dey wanted for im involvement for a violent attack on goment officials wey dey carry out dia lawful duties," di police announcement tok.

Dis no be di first time Portable dey get kwanta wit police.

Police arrest di controversial singer for 2024 sake of say e allegedly refuse to pay debt wey e owe wen e bin buy G-Wagon from one car dealer for di state.

Ogun state police command declare Portable wanted

Wia dis foto come from, Ogun State Police/Facebook

Why police declare portable wanted

Police recall one incident wey happun on 5 February, 2025, wia dem say di singer allegedly attack officials of di Ogun State Ministry of Physical Planning and Urban Development.

"TPL Onabanjo Abidemi, TPL Raymond Lateef and TPL Ridwan Oyero Akinlesi bin dey conduct enforcement exercise for Oke-Osa, Tigbo Ilu Ota wen dem come under attack," dem add.

Dem say di officers bin meet one old man wey turn out to be Portable papa and dem ask for di approved building plan of one "Odogwu bar", but di man say Portable no dey.

Police claim say na later Portable show face wit oda pipo wey be thugs wey allegedly carry dangerous weapons and "carry out violent attack on di unarmed officials."

"Di enforcement officers sustain various bodily injuries but manage to escape and report di incident to di Ota Area Command, wey later report di case to di State Criminal Investigation Department (SCID) for further action."

Authorities say dem arrest nine suspects but Portable escape and dem don call am to come station but e no gree, "na why we go collect valid court order to declare am wanted."

Portable by imsef don come out in recent times ontop social media dey appeal to Nigerians make dem help am beg Ogun state goment.

Who be Portable?

Im real name na Habeeb Okikiola, im be rapper, singer and songwriter.

Di self-proclaimed Son of Shaku Shaku, don climb di ranks of di kontri fastest-rising singers.

Di 29 year old musician come from Ogun State, South west Nigeria.

For one video wey im share for im tiktok page, e tok say na Nigeria rap star, Olamide bring am to limelight.

Dem bin also share video of wia im meet wit di Nigeria rap star.

Currently, im get miilions of followers on Instagram.