Nigeria chief of army staff wey die in office and di high point of dia tenure

Read am in 4 mins

Di death of Nigeria Chief of Army Staff (COAS) Taoreed Abiodun Lagbaja don throw Nigeria in di state of mourning.

To mourn am, President Bola Tinubu give order say dem must to fly di national flag half-mast.

For one statement wey Segun Imohiosen, Director, Information and Public Relations Office for Secretary General of di Federation (OSGF), sign on behalf of di SGF, Tinubu give di order on Wednesday.

Dis no be di first time wey Nigeria Army dey loss a serving chief of staff.

Before now, two oda COAS don die while in service.

Make we go look dem.

Taoreed Abiodun Lagbaja

Di 23rd Chief of Staff Taoreed Abiodun Lagbaja serve Nigeria from June 2023 to November 2024.

Lagbaja, 56, wey be di first COAS under President Bola Ahmed, die afta im bin sick for some time.

Im become oga of di Nigeria army for period wey plenty different kains of insecurity from terrorism, banditry, separatists, clash between farmers and herders, all join to make di kontri unstable.

During im short tenure, Islamist jihadists Boko Haram bin worry as di kontri experience more attacks from dem plus including incidents of kidnapping, especially for north and central parts of di kontri, including di mass kidnapping of more dan 280 children for Kurgi early 2024.

Dem regain dia freedom later for March.

Wit di heavy insecurity and high tension wey Nigeria dey face sake of economic hardship, Gen Lagbja bin make sure say di army no go intervene for di kontri democracy, especially afta many of Nigeria neigbours bin experience military coups.

"We be agents of democracy and no get any desire to scata am," im tok.

Ibrahim Attahiru

Nigeria 21st Chief of Army Staff Lieutenant General Attahiru bin serve from January 2021 to May 2021.

Di 54 years old Lt. Gen. Attahiru die for one plane crash as im bin dey travel from Abuja go Kaduna for official assignment.

Im bin replace Lt. Gen. Tukur Buratai at a time wen insecurity bin dey increase for Nigeria like wildfire.

Di rise of insecurity at dat time make Nigerians call for di Buhari administration to change all di military service chiefs wey bin don dey serve di goment for six years.

Attahiru become COAS for period wey banditry for north west and north central intensify, from raiding poor communities to kidnapping school children and attacking targets including military ones.

Im promise to Nigerians den na to make Boko Haram history by end of 2021.

Dis, im bin try do inside di six months wey im serve as COAS.

Im strategy bin be to promote collabo wey involve all di branches of di military, Navy, Air Force and Army through di counter-insurgency campaign Operation Hadin Kai (Lets Cooperate) wey replace Operation Lafiya Dole (Peace by all means).

Di collabo bin dey very significant for military wey be say, before dis time every branch service chief bin dey do dia own.

Operation Hadin Kai bin no only collabo wit all di oda service chief dem but also include tori pipo plus local pipo for di area.

Attahiru bin get many honors and awards.

Im bin get many medal decorations including UNAMSIL medal, ECOMOG medal, Forces Service Star, Meritorious Service Star, Distinguish Service Star, Grand Service Star, Corp Medal of Honour, Command medal, Field Command Medal, and Field Command Medal of Honour.

Joseph Akahan

Di 2nd Nigeria Chief of Army staff Lieutenant Colonel Joseph Akahan bin serve for di office for 1 year and 9 months, from August 1966 to May 1968.

Akahan, wey die at di age of 31, be one of di leaders of di Nigeria 1966 Counter-Coup, e die for one helicopter crash during di Nigeria Civil War.

Di lack of tribal trust inside di military afta di January 1966 Coup, na im bin make way for Akahan wey become di Commanding Officer CO) of di 4th Battalion Ibadan, afta northern officer refuse to obey di den Igbo CO, Major Nzefili.

Im become COAS for May just before di Nigeria Civil War begin.

Na im bin be di brain behind di sea military campaign wey Nigeria take capture Bonny, establish military naval blockade against Biafra.

For di world of di military, di Bonny Landing na one of di ogbonge achievements of modern Black Africa kontri.