Bitcoin don hit a new record high afta Donald Trump victory, as traders bet say e go come good on im pre-election promises to boost cryptocurrency.
Bitcoin – wey dey volatile - reach just ova $75,000 (£58,000) on Wednesday morning, bifor e fall back slightly.
As wit many policy areas, Trump view on crypto don undergo significant changes ova di years. Once e don call am scam - but more recently e say e go help di US become di Bitcoin "capital of di world", and e don even launch im own cryptocurrency platform.
Attention go dey focus upon di Securities and Exchange Commission, wey some perceive go dey hostile to cryptocurrencies.
Trump don previously promise to remove Gary Gensler, di SEC chair, "on day one" if dem elect am – one move wey go make crypto enthusiasts happy, and push Bitcoin price higher still.
Stock markets dey rally with investors wey dey relieved at di earlier-dan-expected conclusion of di US election, as well as di idea of a unified US government.
Di US dollar and borrowing rates for US government debt don also rise with investors expecting extra US borrowing to fund potentially massive tax cuts.
Investors also expect di US central bank di Federal Reserve to slow di pace of interest rate cuts, meaning investors better returns on dollar-based assets.
Na wetin don become known as di "Trump trade" – a reaction to di expected impact of massive tax cuts, borrowing and rising inflation.