How Zulu king first wife fail to stop di king third marriage

Wia dis foto come from, AFP
- Author, Khanyisile Ngcobo
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Di first wife of South Africa Zulu King Misuzulu kaZwelithini don fail for her legal attempt to stop im plans to marry third wife.
Queen Ntokozo kaMayisela bin go court ahead of di wedding wey dey expected to hold later dis week.
But despite di ruling, e neva dey clear if di wedding go still happun as dem plan.
On Saturday, South African media bin qute one letter reportedly from di king, wey tok say dem don call off of di wedding ceremony "sake of reasons wey dey beyond di control of di royal house".
Polygamous marriages dey recognised for South Africa but only if dem register am as customary weddings.
Dis latest row dey come for di middle of one series of scandals wey don hit King Misuzulu since e come into power just ova two years ago.
Di Zulu king no get any formal political power and di monarch role na within broader South African society na mostly ceremonial, but e dey hugely influential wit yearly government-funded budget of several million dollars.
Bifor e dey crowned, di king bin marry Mayisela for 2021 in a civil marriage.
For her legal argument wey di high court hear on Monday, 20 January, di queen, through her lawyer, tok say di king no fit marry anyone else as dia marriage still dey kampe.
Wetin di law tok

Wia dis foto come from, Getty Images
Under South African law, dem must either dissolve civil marriage or convert am to a traditional union, bifor one man go fit take any more wives.
E no dey clear why di marriage contract no be issue wen di king marry second wife, Queen Nozizwe Mulela-Zulu, for 2022.
But according to South Africa weekly Sunday World newspaper, wey cite one letter Queen Mayisela bin write to elders for di Zulu royal house, di couple bin agree to convert dia marriage from civil to traditional.
Dem bin give di two of dem di option of either divorcing and remarrying or apply for dia conversion by dia legal team, apparently dem choose to do di latter but King Misuzulu "decide to change im mind" for unknown reasons, di queen tok according to reports.
As court reject Monday application to stop di king marriage to Nomzamo Myeni, Judge Bongani Mngadi tok say di queen bin don already agree to di idea say her husband go fit marry oda women, she no fit stop di ceremony from taking place.
Even wit di reported letter, plus wetin di king lawyer tok for court, say di wedding no go take place, contradictory statements don also emerge.
South African news site TimesLIVE report say di bride-to-be say she no sabi anytin about di letter and as far as she understand, her wedding go go on as initially planned.
According to anoda news site, IOL, wey reportedly follow di couple tok, di king insist say im love Myeni and go "marry her by force".
Since im coronation for October 2022, controversy don dey around some of di decisions wey King Misuzulu don make.
For December, e unlawfully suspend di board of di Ingonyama Trust, wey get and dey control very large tracts of communal land for KwaZulu-Natal, wey suppose be for di benefit and welfare of communities under di king leadership for di region.
King Misuzulu na di sole trustee and chairperson of di trust but e no get di powers to hire or fire board members.
Recently, e fire two close aides, wey include im traditional prime minister, in quick succession - moves wey raise eyebrows among royal watchers.
Some pipo also dey question Misuzulu position as king and one legal case currently dey under way wey dey challenge im recognition as monarch by di state.
E rise to di throne sooner dan expected afta im father, King Goodwill Zwelithini, die during di Covid pandemic for March 2021 of diabetes-related complications.
Zwelithini na Zulu nation longest-reigning monarch, as e don serve on di throne for almost 50 years.









