Donald Trump inauguration 2025 timelines

Wia dis foto come from, BBC/Getty Images
- Author, Ana Faguy
- Role, BBC News, Washington
- Read am in 7 mins
Donald Trump don move back to White House afta dem officially swear am in as di 47th president of di United States.
Di inauguration Day include a formal swearing-in ceremony as well as musical performances, celebratory parade and formal balls for evening.
Vice President JD Vance also take oath of office on Monday, joining Trump on stage to officially begin dia new administration.
Trump promise say e go get 'historic' day as e dey plan to sign ova 200 executive actions as e dey enta office.
For im inauguration speech, Trump say im go make "America great" again as e go work to build am.
"My administration no go forget di kontri, di constitution and our God. I go sign historic executive order today."
"I go declare a national emergency for di national border. All illegal entry go stop and we go take all criminals back to wia dem come from."
"We go be a rich nation again. You go fit buy cars of your choice. We go begin tax foreign kontris to enrich our pipo."
"We dey bring back free speech to America. Na only two gender go dey- male and female."
How di inauguration waka
Donald Trump arrive for di Capitol, wia di main proceedings of di inauguration dey take place.
Biden and Trump waka for di middle of massive convoy of various police and secret service vehicles.
And around dem, di streets dey lined up by hundreds of personnel, designed to keep di two top men of di kontri safe.
E waka inside wit outgoing President Joe Biden by im side.
Alreadi, former US presidents and politicians don arrive for di venue of di inauguration.
Meanwhile, no be long drive from di White House to di US Capitol, but di presidential limousine wey Donald Trump and Joe Biden share today bin waka slowly.
Plenti supporters and fans bin gada for di Pennysylvania Avenue route ahead of di inaugural parade today also.
Meanwhile, due to di cold weather, all di ceremonies bin move indoors and dem create a public viewing area for one sport arena.

Timeline of di inauguration
Donald Trump inauguration go start wit service for St John's Church, Lafayette Square wey be a historic Washington DC church afta which dem go drink tea inside di White House.
Musical performances and opening remarks go start for di main event stage wey dey for di West Lawn of di US Capitol building by 09:30 EST (14:30 GMT, 15:30 Nigerian Time). Afta dat go be:
- Di swearing in of Trump and Vance plus di inaugural address wia di president go tok wetin be im goals for di next four years
- Trump go come enta di President Room near di Senate camper to sign key documents
- E go come attend lunch wey di Joint Congressional Committee on Inaugural Ceremonies dey host.
- Afta dat, na parade wey go waka from di Capitol building through Pennsylvania Avenue to di White House.
- Later for evening, Trump go go three inaugural balls wey go happun all ova di city wey dem dey call di Commander-in-Chief Ball, di Liberty Inaugural Ball and di Starlight Ball.
How e go happun gan-gan na say:
- Inauguration Day time:
- 1700gmt (1200est) - Swearing in ceremony (for di official plan say na1647gmt (1147est) times fit change, but planners wan :47 bicos of #47)
- 1726gmt (1226est) - Biden go comot Capitol
- 1755gmt (1255est) - Trump go enta executive doc signing mode
- 1808gmt (1308est) - Congressional Luncheon - Trump & Vance go attend Congressional luncheon
- 1933gmt (1433est) - Trump troop review
- 2030gmt (1530est) - Parade
- 2045gmt (1545est) - Trump motorcade go go White House
- 0050gmt (1950est) Commander in Chief Ball
- 0125gmt (2025est) Liberty Ball
- 0215gmt (2115est) - Starlight Ball
- Trump / Vance:
- 1300gmt (0800est) - Trump go comot Blair House and go St. John's Church
- 1315gmt (0815est) - Di Trumps and Vances go attend prayer service for St. John's Church. Church service dey closed. Dom go go White House afta
- TBC(gmt) - Biden & Trump – Closed. President Biden and PEOTUS go do meet and greet bifor dem go go di Capitol.
- 1755gmt (1255est) - Trump executive document signing for di Capitol
- 1808gmt (1308est) - Trump and Vance go attend Congressional Luncheon for di Capitol
- 1933gmt (1433est) - Trump troop review (Capitol East Front)
- 2045gmt (1545est) - Trump motorcade go enta di White House viewing stand
- 2206gmt (1706est) - President Trump signs documents for di Oval Office.
Wetin be inauguration?
Di inauguration na di formal ceremony to mark di end of one president time for office and di start of a new president administration.
Na di most high-profile part of di transition of power between goment leaders for Washington DC.
One key part of di ceremony include di president-elect reciting di oath of office: "I do solemnly swear say I go faithfully execute di Office of President of di United States, and I go do am to di best of my ability, preserve, protect and defend di Constitution of di United States."
Although im win di election for November, Trump go officially become di 47th president once im say those words.
Vance go take oath of office bifor im formally assume di position of vice president.
Di event also include musical performances, speeches - during di ceremony Trump go address im constituents and lay out im goals for di next four years - and den a parade go follow, and celebratory balls.
Wen e go happun?
Trump second inauguration day go kick off wit service for St. John's Church, Lafayette Square, one ogbonge Washington DC church, followed by tea for White House.
Musical performances and opening remarks dey set to begin for di main event stage – wey dey located on di West Lawn of US Capitol - at 9:30 eastern (14:30 GMT).
E go dey followed by di swearing-in of Trump and Vance as well as di inaugural address.
Trump go den head inside di President Room - near di Senate chamber - to sign key documents to start im new administration.
Di Joint Congressional Committee on inaugural Ceremonies go host lunch wey im go attend afta dat.
Di parade – wey go go from di Capitol down Pennsylvania Avenue to White House – go begin.
Later for evening, Trump go attend three inaugural balls throughout di city - di Commander in Chief Ball, di Liberty Inaugural Ball and di Starlight Ball.
Im dey expected to speak for all three.
How to watch di inauguration?
Typically di demand to watch di inauguration dey high in pesin and tickets na hot cake.
Members of Congress dey receive a certain number of tickets to di ceremony, wey dem fit distribute to dia constituents.
Dis tickets dey free, but e dey hard to get. Americans fit contact dia congressperson directly for tickets.
If you no fit attend in pesin, plenty ways dey to watch am remotely.
Di White House go livestream the inauguration.
BBC go carry di inauguration coverage live on our news channel.
You fit also watch a stream of di inauguration on our website and follow our live page, wia we go bring you updates, analysis and key moments as e dey happun.
Who go attend di inauguration?
Local and federal officials dey expect around 200,000 pipo to show up in Washington DC, wey fit include eager supporters as well as protestors.
Many US senators and congress pipo go also attend, as well as guests of di incoming administration.
Afta Trump, Vance and dia families, di next most important attendees na di outgoing president and vice president. Dis mean say we go see President Biden and Vice President Kamala Harris - wey lose di November election to Trump – wit dia spouses Jill Biden and Doug Emhoff.
Former presidents and first ladies dey attend di inauguration.
Dis year, e go include George and Laura Bush and Barack Obama, though tori be say Michelle Obama no go attend.
Who go perform?
Kontri singer and former American Idol winner Carrie Underwood dey slated to perform America di Beautiful during di inauguration.
"I love our kontri and I dey honoured say dem ask me to sing for di Inauguration and to be a small part of dis historic event," Underwood tok for statement on Monday.
"I dey humble to answer di call for time wen we must all come togeda in di spirit of unity and look to di future."
Di Village People, one American disco group, go also perform for one of Trump inaugural balls, di group announce.
During di campaign, Trump frequently play di group songs - YMCA and Macho Man – for im rallies.
"We know say dis no go make some of una happy to hear but we believe say we suppose perform music witout regard to politics," di band tok for post for dia Facebook page on Monday. "Our song Y.M.C.A. na global anthem wey go hopefully help bring di kontri togeda afta di hot and divided campaign wia our preferred candidate lose."
Country singer Lee Greenwood - longtime friend and collaborator of Trump - and opera singer Christopher Macchio go also perform.










