Court remand Timileyin Ajayi for alleged murder of Salome Adaidu

Collage foto of di late Salome Adaidu and Timileyin Ajayi

Wia dis foto come from, Salome Adaidu/Facebook, CEASER.T/TIKTOK

Read am in 3 mins

Justice Aboki of di High Court for Lafia, Nasarawa State don adjourn di hearing of di alleged murder of National Youth Service Corps member, Salome Adaidu to 27 January, 2025.

Timileyin Ajayi last weekend allegedly kill Salome Adaidu and cut her body into pieces.

Police bin arrest am afta im run out of luck as im bin dey carry her head dey go Uke for Nasarawa State.

Police also drag di 32-year-old gospel singer to court on a one-count charge of culpable homicide wey dey punishable by death.

Court give order make di gospel singer, Timilehin Ajayi, wey dem bin catch wit di head of one National Youth Service Corps member, Salome Adaidu stay for prison.

Justice Aboki give order make e stay for di correctional facility for Lafia sake of say im bin no fit take im plea becos im counsel (lawyer) bin no showface for court.

Timileyin Ajayi dey trend since last week as di suspected killer of Salome Adaidu wey di Nasarawa State police command bin parade.

Local media dey report say Timileyin bin appear for di Lafia High court and na Justice Simon Aboki preside ova di case we dey generate reactions for social media.

Timileyin Ajayi bin don make plenti join-join confessions to media pipo, but Nigeria say im story no dey make sense at all.

Im bin also claim say di late Salome Adaidu na im girlfriend, butbdi familybthroufh dia firstborn Patience Adaidu say " di Adaidu family no sabi am as our sister boyfriend"

Din family still dey mourn di death of dia daughter as dem kontinunto call for justice.

Di late Salome Eleojo Adaidu na former National Youth Service Corps (NYSC) memberv wey dey serve for Abuja wit Nicon Insurance.

Nasarawa State Command Public Relations Officer, SP Ramhan Nansel, bin confam say police recover Salome body wey dey in pieces afta dem bin rescue dis suspect from angry mob.