Tins to know about di seized vehicles EFCC wan sell online

Wia dis foto come from, EFCC/X
Anti-corruption agency di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don announce plans to sell ova eight hundred vehicles wey dem seize from suspects to kontri pipo.
EFCC for statement tok say di auction process go be online.
Di Nigeria corruption agency say dem dey sell di forfeited vehicles in line wit di EFCC (Establishment) Act, 2004, Public Procurement Act, 2007 and di Proceeds of Crime (Recovery and Management) Act, 2022.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
EFCC recover di cars wey range from luxury cars to mid-range Toyota Camry from cases wey dem investigate wey border on corruption, money laundering and cyber crimes.
Di e-auction go start from 20 January to 27 January for different parts of di kontri wey include Abuja, Lagos, Port Harcourt, Edo, Kwara states.
EFCC dey do am in collaboration wit auctioneers wey dem approve to sell di cars give interested buyers.
Di Nigeria corruption police add say make prospective bidders visit di designated platforms of di auctioneers to see di available vehicles and complete di registration process.
EFCC tok-tok pesin Dele Oyewale tell BBC Pidgin say di bidding process go dey transparent, and e go dey in strict adherence to legal guidelines for asset forfeiture and disposal.
Di commission add say dem no go sell di available vehicles below di reserve price, and di winning bid go only dey equal to or above di commission price.
Na bidders wey place di highest bid for forfeited assets na im dem go declare as di winning bidder of the asset at di end of di auction, according to EFCC.
Successful bidders of di auction go get 72-hour window to complete payment via Remita Retrieval Reference (RRR).
BBC Pidgin check through some of di websites of di approved auctioneers. While some don start di auction and don put price on some of di auctioned vehicles, some odas neva start.
Dis no go be di first time EFCC go dey auction assets wey dem seize online. Although critics say di online auction process no dey smooth and e get magomago inside.

Wia dis foto come from, Screenshot from rhiago.com

Wia dis foto come from, Screenshot from rhiago.com

Wia dis foto come from, Screenshot from kurra.ng










