‘My family no sabi say I dey into massage business’

Wetin we call dis Video, Dis na di tori of Rofia Adamu wey dey do massage for pipo but her family pipo no know.
‘My family no sabi say I dey into massage business’

34 year old Rafia Adamu (not real name) dey live double life for di past four years as her family no know say she dey do massage for pipo to earn money.

Di lady wey base for North-west Nigeria tok say na financial problem make her open social media page wey she take start.

And like play pipo begin send her message to go give dem massage for either dia private homes or hotels.

“I don already sabi massage based on say I bin work long time ago for one Spa and also as children our elders dey ask us to massage dia legs or body afta work.”

“Di first few times wey I comot go meet clients fear catch me becos I no wan make any bad tin happun to me but thankfully most of di pipo I don meet so far dey responsible.”

34 year old Rafia Adamu

Rofia say she no go like make her parents know wetin she dey do because dem no go support her.

She get anoda work she dey do for one office wey no dey pay well so she dey use dat one as cover to take comot go do massage.

“Na di money from massage i dey take do a lot of things like paying my children’s school fees and di rest,” she tok.

She tok say she dey collect reach N10,000 per hour for massage session and N50,000 for a day service.

She say she no go like make di husband wey she go marry or im family know say she don do dis kain business before.

“If I get anoda job wey pass dis one I go stop dis one as even my religion no support am.”

Video: Monday Idara