‘Pipo wey no value handwork dey deceive dem sef’ – Professor wey turn welder tok

Wetin we call dis Video, ‘Pipo wey no value handwork dey deceive dem sef’ – Professor wey turn welder tok
‘Pipo wey no value handwork dey deceive dem sef’ – Professor wey turn welder tok

Professor of Engineering for Ahmadu Bello University, Kabir Abu Bilal no be your evriday prof as e be say e get side hustle wey stand am out.

Di prof apart from day to day academic work for university dey run welding workshop for prized part of Zaria city and na wetin don make am become popular.

“Since wey I small I just like to dey create and design tins infact na wetin make me study engineering.”

“But on getting to di university I come see say na theory full dia and me na practical pesin I be and na dat practical lead me to dis place.”

Di prof wey don write several books yarn say when e start welding e get im university colleagues wey no believe am but later some of dem come dey even borrow money from am.

“During dat eight months ASUU strike wey goment no pay us salary wey many lecturers struggle to feed e get some colleagues wey come meet me.”

Di man advise young pipo not to dey look down on any business and to always put in dia best.

“Today you go see young pipo wit ordinary first degree dey think say dem too big to do small work.

“Me i be Professor and I dey proud to call myself a welder.”